Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,205,294 members, 7,991,853 topics. Date: Saturday, 02 November 2024 at 10:02 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / “efcc Gragara” By Chidi Anthony Opara (688 Views)
Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)
(1) (Reply)
“efcc Gragara” By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 9:51am On Oct 19, 2011 |
Like Johnny Walker Dem go waka dey find vote, Dem go waka go north, Dem go waka go south, Lie lie promise Na im full dem mouth. For election day Dem go carry thugs, Dem go carry dem rig di election. As dem enter government, Abracadabra don start, Talk talk No better action don start. Dem go carry plenty plenty people Wey no get wetin to do, Dem go carry dem full office. Na so money go dey waka, Na so money go dey vanish Dey enter dem pockets. Na so so travel travel, Na so so jolly jolly, Dem office come dey inside aeroplane. For another election, Other wayo politicians Wey dem mouth sweet pass, Wey get thugs pass, Go rig them comot, Dem go run go oversea. When dem don hide Di money wey dem thief finish, Dem go show for Naija, Dat time EFCC gragra go start. Dem go arrest dem, Dem go use yeye evidence Carry dem go court. Court go give dem bail, Matter don finish. More dey here: http://www.naforpoems..com |
(1) (Reply)
“Occupy Na Grammar” By Chidi Anthony Opara / Call 07044132067 For Your Printing Job In Abuja. / Rueben Is Dead
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7 |