Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,173,891 members, 7,889,943 topics. Date: Monday, 15 July 2024 at 04:45 AM

"2020 Na Di Year" By Chidi Anthony Opara - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / "2020 Na Di Year" By Chidi Anthony Opara (1004 Views)

Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)

(1) (Reply)

"2020 Na Di Year" By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 4:08pm On Oct 20, 2011
Warehouses
Don turn to worship houses.
Companies don waka,
Churches,
Mosques
Na dem dey now,
Everybody now na prayer warrior.

You need water
You go borehole go buy.
You need security
You go police go pay.
If you need light
You buy generator.
Petrol nko?
You buy from black market.

Every day,
Every day
Dem dey yan say
2020 na di year.
Na di year
Wey light go shine well well,
Wey water go flow everywhere,
Milk and honey sef go flow.

2020 wey dey run dey come so,
Wey be like tomorrow
Na im be di year
Wey every every go boku,
Wey better life
Go yafu yafu for Naija.
So we siddon dey look,
Dey listen to this kin yan.

More Dey here: http://www.naforpoems..com

(1) (Reply)

A Scorcher Of A Book _his Treasure By Kiru Taye. / Become An International Youth Blogger: Call For Applications / 12 Roses For Miss Mississippi

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.