Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,208,301 members, 8,002,184 topics. Date: Thursday, 14 November 2024 at 06:29 AM

Chop Chop Love - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Chop Chop Love (2081 Views)

Its High Time I Chop Chop Missclassy / It Is About Time Men Should Be REQUIRED To Chop Chop Toto! / How I Pranked A Girl That Wanted To Chop My Money - Diary Of A Jobless Nigerian (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Chop Chop Love by Nobody: 5:29pm On Oct 23, 2011
Chop chop love na the type of love wey a naija babe get for a bobo depending on how fat im money for wallet be.This one na wetin dem dey also refer to as conditional love and the love go last depending on how the bobo money for im wallet or bank account fit carry the relationship.Now many naija babes dey exhibit chop chop love to their bobo and na only if the bobo get money na im dem dey love the bobo die.Na dat time u go hear them dey say honey i love u to death or baby i got endless love for u or honeypie i have an immortal love for u etc.Na this type of period u go see the babe dey pursue the bobo all over the place like rat becoz of the bobo money.If the bobo give am one inch omo u go see as the babe go finish all the money for im wallet and bank account and b4 u say Jack Robinson! u no go ever see the babe brakelight again until maybe the bobo don hammar again grin.Abeg my guys the fear of the chop chop lover na then begining of wisdom.Make una shine una eyes well well make dem no play una for mugu oooo grin grin grin grin grin grin grin.
Re: Chop Chop Love by InkedNerd(f): 5:33pm On Oct 23, 2011
Smh, were you jilted by some Nigerian girl? Almost all your comments pertain to something negative towards Nigerian women.
Re: Chop Chop Love by Odunnu: 5:41pm On Oct 23, 2011
Na wetin you plant you go reap. When you dey follow sugar mamas around sake of their money, your small mind no tell you say another babe go pursue you sake of your money.
But come o, na who wan suffer with bobo wey no get money?
Re: Chop Chop Love by Idowuogbo(f): 6:08pm On Oct 23, 2011
Inked_Nerd:

Smh, were you gilled by some Nigerian girl? Almost all your comments pertain to something negative towards Nigerian women.
my dear dont blame him , he probs still bin sheltered by Salvation army due to d bad breakup wiv a Nigerian gal

Pls pardon his reversed brain cells
Re: Chop Chop Love by Nobody: 6:18pm On Oct 23, 2011
hahaha op if the babe wan chop u then make u chop am back and the equation go dey balanced
Re: Chop Chop Love by Nobody: 6:28pm On Oct 23, 2011
[size=14pt]Gallivanting Idiosyncratic Bullshitology!. . . smiley[/size]
Re: Chop Chop Love by MrsChima1(f): 6:43pm On Oct 23, 2011
sexkillz:

[size=14pt]Gallivanting Idiosyncratic Bullshitology!. . . smiley[/size]

Inked_Nerd:

Smh, were you jilted by some Nigerian girl? Almost all your comments pertain to something negative towards Nigerian women.

grin grin grin grin grin
Re: Chop Chop Love by Nobody: 7:08pm On Oct 23, 2011
smh
Re: Chop Chop Love by emofine(f): 8:07pm On Oct 23, 2011
REALITY101:

smh

nmh in agreement

@OP okay now your rhetoric is getting pretty stale and worse predictable maybe you should try mixing it up a bit and surprise us for once . . next time instead of dealing with the usual tired topic of the ills of Nigerian women, why don't you delight us with your knowledge on Nigerian men - I'm sure you have plenty of material to work with.
Re: Chop Chop Love by born2boink(m): 8:25pm On Oct 23, 2011
Odunnu:

Na wetin you plant you go reap. When you dey follow sugar mamas around sake of their money, your small mind no tell you say another babe go pursue you sake of your money.
But come o, na who wan suffer with bobo wey no get money?
I am sad for you

Re: Chop Chop Love by HighChief4(m): 9:39pm On Oct 23, 2011
Lefulefu again?
Re: Chop Chop Love by Nobody: 11:37pm On Oct 23, 2011
born2fuck:

I am sad for you
tell am ooooo grin grin grin grin grin grin grin
Re: Chop Chop Love by claremont(m): 5:32am On Oct 24, 2011
Most males living in Nigeria have experienced these kind of ladies at one point or the other in our adult life, I don't mind so long as they give me what I want in return for the cash. It's more like a glorified form of p-rostitution.
Re: Chop Chop Love by Goldieluks: 7:40am On Oct 24, 2011
Blame it on the greedy Government,
Re: Chop Chop Love by harakiri(m): 7:47am On Oct 24, 2011
@claremont,

You can say that again. A lot of guys are dating (even marrying) pros.ti.tutes. It's not only the lady who stands on the sidewalk at night that's a pros.ti.tite. Anyone who sells their body or affection for material gain is a pros.sti.tute. The irony is, MOST ladies (even the ones on this forum) fall into this category. The very few exceptions will examine the man to be sure he has future prospects before deciding to "manage" him during his struggling days (this doesn't deter them from dating richer guys who don't give a $hit about them on the side).

It's really sad but that's how it really is. I have no issues taking a lady out or buying her gifts but at some point, they begin to reveal their true selves and become horrendously demanding. If you don't give them what they want, they'll say you don't care about them or love them. If you harshly refuse to comply,they'll claim they were merely "testing" you to see how you would react (I've heard this bull$hit one too many times and I wonder if they would be saying the same thing if I had complied).

It's tiring coz even the so called "independent ladies" do it too (on a grander scale).
Re: Chop Chop Love by freecocoa(f): 11:00am On Oct 24, 2011
Lefu-swag
I'm highly touched and concerned by your present state of emotional trauma,I've been reading your posts and I've come to the conclusion that you need someone to reach out to you,so out of the goodwill of my heart,I'm volunteering to help.
Just tell me how much she ate from you when you were her maga,I'm willing to give you every penny you spent cos I understand how you feel,I know you won't heal if you don't get your money back,we are tired of you suffering and posting jonsing threads,just paste your account details please and put a stop to the hurting.
Re: Chop Chop Love by Nobody: 12:06pm On Oct 24, 2011
ladies should allow diz men be now.we all ve brothers,how would we feel if other ladies are draining our brothers.everything is vanity! U cant carry blackberry,brazillian hair,'tantalizers' stomach to heaven.life is more than all diz.
Re: Chop Chop Love by inspirizu(m): 10:52pm On Oct 24, 2011
U know no before niiiii abi wish kain ranting u cum rat 4 here na, Abeegi lefu rege lefu don make me miss ma show obo!
Re: Chop Chop Love by tellwisdom: 2:44am On Oct 25, 2011
CHOP CHOP LOVE grin grin grin grin. very funny grin grin
Re: Chop Chop Love by toyemz(f): 3:42am On Oct 25, 2011
freecocoa
Lefu-swag
I'm highly touched and concerned by your present state of emotional trauma,I've been reading your posts and I've come to the conclusion that you need someone to reach out to you,so out of the goodwill of my heart,I'm volunteering to help.
Just tell me how much she ate from you when you were her maga,I'm willing to give you every penny you spent cos I understand how you feel,I know you won't heal if you don't get your money back,we are tired of you suffering and posting jonsing threads,just paste your account details please and put a stop to the hurting


I second that and am willing to contribute £N20.00
Re: Chop Chop Love by BlackLibya: 3:50am On Oct 25, 2011
it is so hard to understand nigerian pidgin because nigerians cannot spell regular english.

A bobo is a fool.

A booboo is a term of affection.

D.amn, "im" is "I'm" the correct spelling is " 'em " .

bleed
Re: Chop Chop Love by InkedNerd(f): 6:23am On Oct 25, 2011
BlackLibya:

it is so hard to understand nigerian pidgin because nigerians cannot spell regular english.

A bobo is a fool.

A booboo is a term of affection.

D.amn, "im" is "I'm" the correct spelling is " 'em " .

bleed

Want me to teach you some pidgin?
Re: Chop Chop Love by Nobody: 6:33am On Oct 25, 2011
sexkillz:

[size=14pt]Gallivanting Idiosyncratic Bullshitology!. . . smiley[/size]

grin
Re: Chop Chop Love by tellwisdom: 12:09pm On Oct 25, 2011
it is so hard to understand nigerian pidgin because nigerians cannot spell regular english.

A bobo is a fool.

A booboo is a term of affection.

D.amn, "im" is "I'm" the correct spelling is " 'em " .

bleed

Bro, did you in anyway, INHALE MARIYUANA?? embarassed embarassed
Re: Chop Chop Love by Nobody: 12:35pm On Oct 25, 2011
BlackLibya:

it is so hard to understand nigerian pidgin because nigerians cannot spell regular english.

A bobo is a fool.

A booboo is a term of affection.

D.amn, "im" is "I'm" the correct spelling is " 'em " .

bleed
Bobo means a guy or a dude.By the way are u a libyan returnee? grin
Re: Chop Chop Love by tellwisdom: 12:38pm On Oct 25, 2011
Bobo means a guy or a dude.By the way[b] are u a libyan returnee? [/b] grin

I was abt asking him the same tin grin grin. But i wan first check em brain first make i no mistake am for normal human embarassed embarassed
Re: Chop Chop Love by Nobody: 12:39pm On Oct 25, 2011
freecocoa:

Lefu-swag
I'm highly touched and concerned by your present state of emotional trauma,I've been reading your posts and I've come to the conclusion that you need someone to reach out to you,so out of the goodwill of my heart,I'm volunteering to help.
Just tell me how much she ate from you when you were her maga,I'm willing to give you every penny you spent cos I understand how you feel,I know you won't heal if you don't get your money back,we are tired of you suffering and posting jonsing threads,just paste your account details please and put a stop to the hurting.
u wan take style derail my thread abi?
I dey talk about naija babes wey dey chase we bobos all over the place because of money and u dey here dey talk about me losting money to naira hungry naija babes grin.Abegi i dey try sympetise with my pallys for naija wey dey still suffer from the hand of naija babes.I don get sense pass that level to dey fall for naija babes scam grin grin grin grin
Re: Chop Chop Love by Nobody: 12:42pm On Oct 25, 2011
tellwisdom:

I was abt asking him the same tin grin grin. But i wan first check him brain first make i no mistake am for normal human embarassed embarassed
Abeg no mind jor grin.I sure say na one of those nigerians wey libyan rebels chase out of their country.See im coconut head as e dey come here dey try to form.Wetin sef grin?.So because he go libya im think say he don see the world.I dey wait to hear wetin im be bring back from libya grin.
Re: Chop Chop Love by MMM2(m): 12:44pm On Oct 25, 2011
angryangryangry
Re: Chop Chop Love by freecocoa(f): 1:02pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

u wan take style derail my thread abi?
I dey talk about naija babes wey dey chase we bobos all over the place because of money and u dey here dey talk about me losting money to naira hungry naija babes grin.Abegi i dey try sympetise with my pallys for naija wey dey still suffer from the hand of naija babes.I don get sense pass that level to dey fall for naija babes scam grin grin grin grin
Your pallys for naija?where you think say you dey abeg?you wey I see for oshodi the other day where you dey chop ewa goin for hot sun,no dey deceive yourself,you no get money,any girl wey you think say dey chase you,na just your imagination.
Re: Chop Chop Love by Nobody: 1:07pm On Oct 25, 2011
freecocoa:

Your pallys for naija?where you think say you dey abeg?you wey I see for oshodi the other day where you dey chop ewa goin for hot sun,no dey deceive yourself,you no get money,any girl wey you think say dey chase you,na just your imagination.
u wan take style yab me abi? grin.Na wich one come be ewa? grin.For ur information na omelette na im i dey chop everyday cheesy.
Re: Chop Chop Love by freecocoa(f): 1:14pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

u wan take style yab me abi? grin.Na wich one come be ewa? grin.For your information na omelette na im i dey chop everyday cheesy.
Swear say you don ever see something wey resemble omelet before,because you hear the word for film U̶̲̥̅̊ wan come form,you go just fall sick if you dey eat only one type of food everyday na,especially the type wey U̶̲̥̅̊ wan claim.

(1) (2) (Reply)

Ladies Do You Like It When Your Boyfriend/husband Loose Or Plait Your Hair / How Would You Handle This? / Why Must The Guy Be The Only One Spending

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 67
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.