Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,207,663 members, 7,999,892 topics. Date: Monday, 11 November 2024 at 03:47 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Politikal Nonsesikal (840 Views)
(1) (Reply)
Politikal Nonsesikal by Orikinla(m): 11:08am On Sep 17, 2007 |
[b]Politikal Nonsesikal For Fela Anikulapo Kuti Bikos dem think say Fela don die Na him make dem do them political nonsesikal for Naija Dem don dabaru democracy As Baba Abami Eda Fela call am, na democrazy Bikos na political madness they reign for Naija Wuru-wuru politiks E dey For Nigeria E dey Maurice Iwu do wuruwuru for April Elections Na political April Fool for Atiku Baba Iyabo give Atiku political TKO Even bifor dem do presidential election Baba Iyabo use Igbo man Iwu to do wuruwuru Kangaroo elections As IBB use Nzeribe to dabaru June 12 Until the demonic Abacha kon jail MKO Abiola Until Abdul kon use poisoned tea kon kill Abiola Gambari and Fulani don dabaru Naija With dem Soja-power and Banza politiks Wuru-wuru politiks E dey! For Nigeria E dey! Mago-Mago politiks E dey! For Nigeria E dey! Jibiti politiks E dey! For Nigeria E dey! Fiditi politiks E dey! For Nigeria E dey! Politikal 419 E dey! For Nigeria E dey! Politikal hysteria E dey! For Nigeria E dey! Papa Deceive Pikin (PDP) Pikin Deceive Papa (PDP) Don dabaru Nigeria Ibori don steal all our oil money Odili don steal all our oil money Alams sef don steal our oil money Baba Iyabo Na him be their supervisor For the looting of Nigerian treasury Under the masquerade of their political snobbery Dem dey commit daylight robbery From Naija Delta to Abuja Politikal criminals don wreck Nigeria Politikal pen robbers do loot Nigeria Politikal hypocrites don spoil Nigeria Politkal prostitutes don scatter Nigeria Politkal mugu kon dey look like politikal mumu. My people, which one u be? Politikal pen robber? Politikal mugu or political mumu What of the politikal zombies Whey dem use to rig election And the politikal zombies dem kon pafuka for nothing. My people still dey do siddon dey look like mumu My people still dey do siddon dey look like mugu. Nobody dey yab again since Fela die Na so so lie-lie dem dey lie Since Fela die But dem know know say Fela never die patapata Bikos For Ever Lives Afrika Fela! For Ever Live Afrika Fela! I no go forget you Fela! I dey hear your voice dey echo for Kalakuta Republik From Afrika ’70 for Idi Oro to Egypt ’80 for Ikeja Dem still dey shack palmwine burukutu for Afrika shrine Your Afrobeats still dey echo all over Afrika For Ever Lives Afrika Fela![/b] By Orikinla Osinachi September 17, 2007. From the lyrics of the Afrobeat performance single to be released soon. The world premiere will be only on Radio Palmwine, the number 1 Africa Live Radio Webcast and later on the BBC Radio before other stations.
|
(1) (Reply)
Yar’adua Proposes N77bn Supplementary Budget / Obj's Selection Is Telling On Us - Nigerians Deserve Appology / Do You Love Or Regret Being A Nigerian
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8 |