Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,169,000 members, 7,873,224 topics. Date: Thursday, 27 June 2024 at 10:06 AM

"Bend Down Market" By Chidi Anthony Opara - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / "Bend Down Market" By Chidi Anthony Opara (593 Views)

Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)

(1) (Reply)

"Bend Down Market" By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 3:54pm On Nov 20, 2011
Our country
Na bend bend country.
Our government dem
Na bend bend government.
Na im make
Our life bend bend.

We dey do bend bend election,
We dey carry bend bend people
Put for inside office.
Di bend bend people
Dey choose bend bend people
To work with.
Everything bend bend,
Our pocket sef
Follow bend bend.

Christmas
Don bend dey come.
New year too
Don bend dey come.

Bend down market
Na im dey help us.
Bend down cloth dem,
Bend down shoe dem
Bend down everything.
Bend down market
Na im dey help us.

(1) (Reply)

Kingdoms Of Conflict Is Truly An Interesting Book / Bold2 White 4 Sale / Free Science Fiction Short Story...

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 5
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.