Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,760 members, 7,882,618 topics. Date: Sunday, 07 July 2024 at 10:18 AM

U Fit Marry A Naija Babe Wey Dey Very Beautiful But Too Dey Break Bottle? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / U Fit Marry A Naija Babe Wey Dey Very Beautiful But Too Dey Break Bottle? (728 Views)

Why Do Very Beautiful Girls Make This Mistake??? (2) (3) (4)

(1)

U Fit Marry A Naija Babe Wey Dey Very Beautiful But Too Dey Break Bottle? by Nobody: 4:23pm On Dec 11, 2011
For those of una wey no know wetin breaking bottle mean e mean say wen person speak very bad grammar like Oga presido Goodluck wife.Anyway make i yarn una wetin i come witness yesterday.
Yesterday one of my fellow london yuppy pally wey dey married to a benin girl come invite me for the naming ceremony of im pickin.This my plly wife fine no be small.she come yellow well well like ogugua,come get this troublesome very small mouth like freecocoa own and come get bombastic s3xy legs like mzdarkskin own and she come even set her brazilian wig for head like cynthiafred for the naming ceremony.Anyway wetin come fear me na wen this my pally wife come carry microphone frm the MC hand while holding her blackberry touch for her left hand and she start to dey yarn her bad grammar bombs for the mic."Ladies and Gentlemans!" she start to yarn in her deep masculine voice like Mrs Chima own all in her bid to welcome the guest,"I am so glading to have u all with me and husband in celebration.Rice and chicken very boku(plenty) and will belleful u all.lest i forget there is akpu in the kitchen for all the akpu lovers.thanks u!"
Chie!! i come wonder.this my pally wife na university graduate and even sef na english she read so how come she go just dey break bottle like this nah.Na so i just open mouth dey look and na so my pally just take style bone face and act as if nothing happen.Some of my pally oyibo friends even come for the ceremony so why im wife go just fall im hand like this i just come dey think embarassed.
So guys on the house una fit marry a very beautiful babe wey dey break bottle for grammar? grin

(1)

She Loves Me,but She Cannot Cope Withmy Perfomance,coz Its More To Handle / Please Help A Friend In Quandary / Why Is It That Most Working Class Girls Doesn't Date Jobless Guys?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.