Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,191,656 members, 7,945,000 topics. Date: Tuesday, 10 September 2024 at 09:38 AM |
Nairaland Forum / Dadisoft's Profile / Dadisoft's Posts
(1) (2) (of 2 pages)
Politics / Re: I’m Not Interested In Calling Others Names, Atiku’s My Elder — Peter Obi by Dadisoft(m): 8:45am On Dec 06, 2022 |
CEwog91:NNPP and LP dey work for PDP. |
Politics / Re: See The Major Difference Between Peter Obi & Bola Tinubu On Foreign Trips That W by Dadisoft(m): 2:43am On Dec 06, 2022 |
Abeg you fit do video of how to buy sense when someone no get sense again. |
Politics / Re: Why Is No One Decamping To Labour Party? by Dadisoft(m): 2:25am On Dec 06, 2022 |
How many of una don notice say even all the obidients wey dey insult people everywhere no one be member of LP. Them just dey print t-shirts and banner for rallies but none of them be members. |
Politics / Re: Could Lagos PDP Campaign Rally Be Their Worst So Far? by Dadisoft(m): 2:14am On Dec 06, 2022 |
Omeise: Chai Buhari don really frustrate una to the point wey una no even sabi use common sense dey display una laziness for public. Imagine 5 million Nigerians dey reason like this meaning say e no fit ever better for Nigeria again. 1 Like |
Politics / Re: Tinubu Chatham House Disaster- What Really Happened (video) by Dadisoft(m): 2:00am On Dec 06, 2022 |
Una never tire to open thread about chatham house? Tinubu this, Chatham house that. We don see everything since make una find another story wey make sense. Shame no dey even catch una to see una presidencial candidates dey go do interviews for another man land just to impress gullible citizens? 2 Likes 1 Share |
Politics / Re: I’m Not Interested In Calling Others Names, Atiku’s My Elder — Peter Obi by Dadisoft(m): 1:38am On Dec 06, 2022 |
JOemmy: If this packaging na wethin you call brilliant and humble then I fit confirm say brilliant and humble people no dey wherever you come from. Abeg no offense. 2 Likes 1 Share |
Politics / Re: I’m Not Interested In Calling Others Names, Atiku’s My Elder — Peter Obi by Dadisoft(m): 1:36am On Dec 06, 2022 |
Obi know say him no go win and him dey work for PDP to comot Apc from power. All these talk na just to remind Atiku not to forget am if PDP win because Obi no say him no get chance. 3 Likes 1 Share |
Politics / Re: How Can A Man With No Single Governor Supporting Him Win Election In Nigeria? by Dadisoft(m): 1:07am On Dec 06, 2022 |
dominic17: I believe say you no dey stay Nigeria be that. The governors push crowds in the states. Except the people just don't like the governor if not the governors all have the mandate to deliver their states for their parties when it comes to presidencial elections. Also the governors are part of the major sponsors for the parties for presidencial elections. Imagine how much state funds are being pumped APC and PDP from all their governors, senators and so on. Those are the major driving force of an election. Obi doesn't have such but is relying on the simple noise people are making for him. On election day, while the governors of each state have mobilized deep into the grassroots to share better money the millions of hungry Nigerias that are willing to vote, that is when you will realize that who no give shishi no dey win election. Even if Obi LP give shishi it no fit reach what Apc and Pdp will give and that is were they will mess obi up. LP chances are just in probably some urban areas were people are not so hungry and will use their mind for him. Aside that, no voter in the rural areas will dare vote a candidate without shishi. |
Politics / Re: How Can A Man With No Single Governor Supporting Him Win Election In Nigeria? by Dadisoft(m): 12:55am On Dec 06, 2022 |
Na only baby political analyst and ipob/obidient online fighters still believe say Peter Obi fit win this election. The truth of the matter be say if Apc as ruling party no win, na PDP wey be main opposition party e go favour pass. Even Peter Obi himself know how far na why him no dey spend him own money and na why him no wan offend Atiku dey call am him senior brother wey teach am work. Obi just dey prepare to help PDP comot Apc from power. If PDP win Obi go still run back to PDP to collect compensation as maybe CBN governor. |
Politics / Re: Dele Alake: Tinubu Showed The Calibre Of His Team by Dadisoft(m): 12:41am On Dec 06, 2022 |
I just dey look as things wan unfold in 2023 because many people go shock. My major problem with obidients be say them go just dey all manner of social media dey fight and insult people and dey find different propaganda against other candidates instead of them to focus on better Grassroot Mobilization and start dey give shishi. E go really pain to see say na social media Obi presidencial aspiration go end. Imagine after election on social media Obi get 11 million votes with mouth and him clear the whole South east for social media meanwhile for inec office as them dey count the real votes on ground nobody dey hear LP dey comot from ballot box. E go shock una abi? 5 Likes 1 Share |
Politics / Re: President Buhari Issues Directives To Nigerian Army Ahead Of 2023 Election by Dadisoft(m): 9:52pm On Dec 05, 2022 |
Good one from the outgoing president. But we still know say the army no go hear word. Make we no forget say them still dey take orders from some unknown political ogas like wethin happen for end sars protest in Lekki. We suppose know the parties wey top military bosses dey. |
Politics / Re: Estimated 2023 election results for apc,pdp,lp by Dadisoft(m): 8:16pm On Dec 05, 2022 |
ImmaculateJOE: Less I forget that CPC you mentioned was like a major opposition party to PDP as at then which was why Tinubu came up with the plan to merge with them. CPC was so much well more known as at then my brother. |
Politics / Re: Estimated 2023 election results for apc,pdp,lp by Dadisoft(m): 8:13pm On Dec 05, 2022 |
ImmaculateJOE: Baba that is still exactly what I'm talking about. It is all about the ruling party and the major opposition party that have their members strong in every state as governors, senators, house of rep local government etc. I didn't say it is impossible for Obi to win south east, but I'm tell you it will be hard for him to get 80% as you claim. |
Politics / Re: Estimated 2023 election results for apc,pdp,lp by Dadisoft(m): 7:52pm On Dec 05, 2022 |
ImmaculateJOE: Calling 80% is sentiment because I dey clear you say e go hard to get 80% from states that are governed by PDP or APC. E be like say you no even know how election dey work for Nigeria. For example you no get or belong to any political party in your state. Now either Apc or PDP get thousands of members so people like you wey no dey political parties can vote freely any of your choice. Now e be the responsibility of those wey dey political parties to mobilize in their own capacity and LP no get that strong capacity in the whole SE. Try imagine why crowd always dey political rallies whether them say na hired or not. That is the same way them dey mobilize on election day. The same crowd you see voting LP will be almost same or more voting PDP and APC. |
Politics / Re: E-transmission Of Poll Results: INEC To Meet NCC, Telcos, On Tuesday by Dadisoft(m): 7:18pm On Dec 05, 2022 |
Okay na so some people go dey when them dey announce results after election. E shock you abi 1 Like
|
Politics / Re: My Prediction Of How 2023 Presidential Election Results Will Be Announced by Dadisoft(m): 7:04pm On Dec 05, 2022 |
4teenblaq: Yes oooo na why I wan save am |
Politics / Re: My Prediction Of How 2023 Presidential Election Results Will Be Announced by Dadisoft(m): 6:59pm On Dec 05, 2022 |
4teenblaq: This meme go sweet for people wey go dey watch the election results as them dey announce am. Thank you make I rush save am. 1 Like |
Politics / Re: Yakubu Dogara Dumps APC For PDP by Dadisoft(m): 6:42pm On Dec 05, 2022 |
And some people still dey believe say all the christians for north go vote Peter Obi. |
Politics / My Prediction Of How 2023 Presidential Election Results Will Be Announced by Dadisoft(m): 6:40pm On Dec 05, 2022 |
If you understand Nigeria politics inside out you will know that it will not be hard to predict how it will end. We know there are just two major parties in Nigeria while the rest parties are just elements of people from either of the two major parties. After the election with Buhari and Jonathan I believe we can remember how it shocked people even the Mr "We will not take this". That's how after 2023 elections when they are counting results all people will be hearing is APC and PDP. That time many people will start wondering if LP and other parties were not in the ballot. Even many people that can beat their chest that them and their full community voted LP or other parties will not understand how their ballot papers didn't enter inec counting room. There shall be so much weeping and drinking of sniper that day because it will be very painful. I urge you all to mark this my post somewhere because it is a reality. Many people will break their TV while watching the results being counted. I come in peace with my prediction because I won't be available to join the tears as I don't have any candidate to waste my vote for. Abeg anybody that's has sweet meme for people that cry help me share the tears here. 1 Like |
Politics / Re: Estimated 2023 election results for apc,pdp,lp by Dadisoft(m): 6:27pm On Dec 05, 2022 |
ImmaculateJOE: My brother leave sentiment it will be impossible for Obi to win all south east because all of them are either PDP or APC strong hold. Vote go dey seriously shared for that region between LP, PDP and APC which go be very bad disadvantage for Obi. Even if Obi manage win anyhow, the difference no go dey so much compared to the way PDP and APC go stretch LP for other regions in Nigeria especially for North. In as much as people really love Obi, the bitter truth be say e go hard for Peter Obi to win this election no matter what. 1 Like |
Politics / Re: [PHOTOS]: Heavy Protest Against Tinubu At Chatham House UK by Dadisoft(m): 6:15pm On Dec 05, 2022 |
I no see anything heavy for here abi na the backyard them dey do their own? Because even Reno and others dey the front dey campaign for Tinubu. |
Politics / Re: Tinubu Reveals Why He Has Declined Interviews And Debates by Dadisoft(m): 5:58pm On Dec 05, 2022 |
favor914: My brother sorry to disappoint you, I no wan brag about how many countries I don visit and as I speak I no even dey Nigeria till after the election na why I no dey vote shishi. Almost all countries I have visited have this bad impression about Nigerians except person humble himself well and them just get to like you for who you be and not for the Nigeria itself. Probably na you never travel outside if not you no go talk wethin you dey talk. Nigeria need help whether we accept am or not. I rest my case. |
Politics / Re: Tinubu Reveals Why He Has Declined Interviews And Debates by Dadisoft(m): 4:40pm On Dec 05, 2022 |
Slawomirr: My brother the whole world don already take Nigerians as big fools no be today e start. Any of the candidates wey win go still make the world continue to see Nigerians as fools because no one dey different from each other. So all this things you dey talk no make sense because the only sensible people wey dey Nigeria as e be now na those people wey go dey their house on election day dey mind their business. The number of people wey go eventually go vote for any of the candidates go show the number of brain dead people dey the country. |
Politics / Re: Buhari Attended Churches In 2015 (Throwback Photos) by Dadisoft(m): 2:38pm On Dec 05, 2022 |
Bigchristo: Why him no go visit mosques. Buhari na muslim wey visit church, Obi na christian wey suppose visit mosques so that e go balance if them wan dey use this rubbish as comparison. |
Politics / Re: Buhari Attended Churches In 2015 (Throwback Photos) by Dadisoft(m): 2:36pm On Dec 05, 2022 |
Britishpea: Exactly my brother, me self confuse for this kind yeye comparison. If Buhari visit church then Obi suppose visit mosques to balance the equation. E be like say many people no dey think with their head for this country. |
Politics / Re: Buhari Attended Churches In 2015 (Throwback Photos) by Dadisoft(m): 2:33pm On Dec 05, 2022 |
But Buhari na muslim wey visit church so I no understand the comparison here. Why them no dey ask why PO no go for event for mosques as him be christian. |
(1) (2) (of 2 pages)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52 |