Stats: 3,181,505 members, 7,914,337 topics. Date: Wednesday, 07 August 2024 at 11:21 PM |
Nairaland Forum / Jeremyparker's Profile / Jeremyparker's Posts
(1) (of 1 pages)
![]() |
EgunMogaji: Ah Mr Boeing, I claim am o. Papa God don dey use u prophesy say my business go expand to include Water business. No mind dem, like most laws in Naija, its not really bin enforced so business still dey boom. How market naa, u still dey produce enough milk for whiteman? :-) 1 Like 1 Share |
![]() |
EgunMogaji: Ha! Says the man who waits all day anxiously for my reply. He he |
![]() |
EgunMogaji: Ha ha. 1st of all. I dey reply you late because i actually run my business and do things that matter. When i finish, wen i dey break, I go write you. Eryaa, i didnt know you are so jobless that o. So jobless setey, to dey reply me be like highlight of your day. Na wao for you Mr Boeing. The difference between Richness and Poverty. Richness is when you are happy doing wetin u luv and being satisfied and even contented by it, like I am. Poverty, is when person claim say dem don build aeroplane finish, but dem sidon dey wait for 'common street hawker' to reply them, because na the only true thing wey dey make am happy. Eryaa, a beg no cry o, i go try to dey reply you sooner okay? |
![]() |
EgunMogaji: Superiority complex a psychological defense mechanism in which a person's feelings of superiority, counter or conceal his or her feelings of inferiority. He he he |
![]() |
[quote author=EgunMogaji post=47249259][/quote] Ha ha, bros, na so so laugh you ma de make me laugh here. I know na phone I dey sell, but I dey proud and happy about it. I am happy doing what I do. E de provide food for my family. At least I don marry, you, for there, you no go fit marry born pickin for their because upon all the money wey you claim say u dey make, e no go reach for you to support your sef, not to talk of a wife and chikdren. And wait o, who be jonathan sef. I be proud igbo but i no do follow follow. Buhari na my president. I dey proud of wetin I dey do. Na from this hustke wey I dey pay for the degree wey I de do now. So all that one wey you dey talk, na for all those people wey dey wish for things wey pass them. Me i dey happy with the one wey papa God give me. I get shop for Enugu and I get 2 shop for Benue. Na papa God do am. I be business owner. You, you be white man cashcow, na so the oyinbo dey milk ur cow breast dey give u small change and u dey happy. Na wao for you o. You think say because you dey make small money for oyinbo land, dey buy Iphone. You better pass person? Na so so laugh I dey laugh because, you wey think say you dey up their, why u know say, abeg this guy na street hawker, make I leave am. You come dey follow claim for here. No need for me to slap u bros, because you don slap your sef taya sef. I come dey pity u sef. Eryaa :-) |
![]() |
EgunMogaji: Mr Boeing, you get problem o. I know your kan person. Na una go enter my shop, una no go get money to buy Tecno, but una go condem Tecno finish, na so una go blow grammer from London to Fowl nyash., claim say una work for LG, u na sabi everything for phone. When una finish, una go come de price Nokia 3310. You wey sabi finish, why you know come Naija come manufacture yiur own naa. You come dey claim ova sabi for another man sweat. Wait o, you no go fit come Naija because, you no get paper, so wen u land, you no go fit enter that your oyinbo land again. Abit u be one of this big msn pickin wey ur papa chop money for Jonathan regime? Abeg no fear o, BABA don prepare room for una type for Kuje prison finish. Bros, make u take time o. |
![]() |
EgunMogaji: PLEASE NAIRALANDERS, make una help me. This look like something wey person go use money import from china come de assemble am for naija? Abeg, make we celebrate our own.
|
![]() |
EgunMogaji: Me I dey proud of my tribe. You no be oyinbo o. No go sidon for oyinbo land de think say you be oyinbo. Na una type UK de deport. I am a proud Nigerian of the Igbo tribe. Guy, abeg no come use Nairaland blow us lie here. Which Boeing you don work for, wey you sidon here de argue with a mobile phone trader for net. Make I no talk too much sef. You know wetin, you said STFU to me. That one alone tells me alot about you. I Stand by my opinion? If you wan, do backtumble for your opinion sef. E no go change the fact say, you don disgrace yourself finish. I no work for boeing but i love technology and i dey follow am steady. E don tey wey i see this thing for net o. Mista I don work for boeing, I go buy am this machine. I think i go buyam before you sef, u wey don work for boeing but sidon dey wait for SALE. Abeg, no vex person here o. I go from here land u slap for there. (I stand by my opinion that he assembled it from parts, he did not manufacture it in Nigeria) Are you sure? , because of you, i did my laptop go find this pictures wey i save before him remove the blog. Since then, e build factory finish before i dey see this for net now. PLEASE NAIRALANDERS, make una help me. This look like something wey person go use money import from china come de assemble am for naija? Abeg, make we celebrate our own.
|
![]() |
EgunMogaji: I am an igbo guy and coming from the east, this thing is very innovative. I ve been to benue and this price is cheap because, those Bajaj and Simba ate selling it there for 500k unless you are lucky to get one from the government which subsidies it fir the farmers. Also, If you saw his previous updates showing how he was making this tricycle, i dont think you would say he Only assembled it. I have a feeling some lawyer must have advised him to take if off the website to avoid copying. From what i saw, he first of all, designed it multiple times on paper. Then he began building the machinery for pressing. The only thing i think he imported here was the engine but , even Airplane manufacturers like Airbus, Boeing dont build everything they use, its called contract manufacturing of some components. But the frame and chassis, from what i saw in the postings are 100% manufactured here in nigeria by himself. Something else i noticed from the site was how he converted the drum brakes on the back wheel to Hydraulic disc brakes. We keep saying people in diaspora should bring something back. But when they do, we insult it and criticize it not because its not innovative, but simply because it made by a Nigerian. If na oyinbo make this thing now, we go all wan buy am. I looked up this guy, he is only about 30yrs old and he clearly isnt a dummy. He runs other companies in California and is probably making a lot of money. Morw grease to his elbow. Please lets celebrate one of our own. 1 Like |
![]() |
Its really wow my brother. If we de do this kind thing for naija, we no need china atall atall. I salute the bros wey do this. |
![]() |
[color=#000000] A Benue indigene, Mr Stine Chenge, of Chinatown & Benue Valley Vehicle Manufacturing Co,. has designed, engineered, manufactured and assembled a vehicle for the first time in Benue State. The product named ‘WAZOBIA’ keke is a copyright protected (NCC Certified) light weight portable multi-purpose cargo vehicle (pictured above) which has proven itself as a versatile companion for laborers (Plumbers, Electricians, Mechanics, Vulcanizers), Courier & delivery businesses, Farmers (Carrots, Maize, Potatoes, Beans, Groundnuts, Rice, Cassava, Onions, Tomatoes, Vegetables, Fruits, etc), commercial food vendors and general town services. Unlike other manufacturers, the products are not built outside Benue or in China and only assembled in Benue, the vehicles are 100% designed, engineered, manufactured by Benue indigenes and assembled in Gboko and Makurdi. Speaking to Benue.com.ng, Mr Chenge said, ”... Since our products are manufactured within Benue State, our prices are considerably cheaper at just N290,000 per units from 1-10, N250,000 for units from 11-50 and N210,000 for unit from 51-100. Our current production capacity per month is 50 units. This is cheaper than the Chinese or Indian products currently being sold for N450,000 and sometimes as high as N650,000.” Mr Chenge added that the benefits and implications of this accomplishment are enormous. From employment, to tax revenues to the state, to reinforcing Benue State’s position as a major economic player at a national and global stage, as the company will also be selling the products to neighboring States and, export to neighboring countries like Republic of Benin, Cameroon, Togo, Chad, Ghana in the near future. “It is our desire to continue to improve and make many models and call on Businesses, Government and the good citizens to patronise our products. Our products can be purchased directly from us by visiting our website www.wazobiakeke.com or via Konga, He concluded.
|
(1) (of 1 pages)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50 |