Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,198,452 members, 7,968,241 topics. Date: Sunday, 06 October 2024 at 09:43 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Nigeria has finished me!! (197500 Views)
[Classified Video, MUST WATCH]: NNAMDI KANU HAS FINISHED NIGERIA!!! / Nigeria Has Finished Me: Lessons Learnt / Nigeia Has Finished Me Rejoinder (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (118) (Reply) (Go Down)
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:11am On Jul 07, 2016 |
hahaha..chaii. these guys too funny o |
Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:14am On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:lwkmd. My brother, wetin u think say we fit do na? Me tire oh. 5 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:16am On Jul 07, 2016 |
OmoAjowa7:what's your point? 11 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:19am On Jul 07, 2016 |
coolestdude01: Na d question be that....what's the way forward?? Abi make we gather go aso.rock tell buhari say we no dey comot there until we get better job? if dem wan shoot us make dem shoot? abi na to use leg run comot from this country? 46 Likes 2 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:24am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:Not a bad idea oh..but make them no go shoot person oh. This country wey killing anyhow no be new tin 26 Likes 1 Share |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:29am On Jul 07, 2016 |
coolestdude01: Oju zobo ni baba gbe wa ooo Boys no dey smile at all...Nothing do you. We sabi that life 2 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:33am On Jul 07, 2016 |
OmoAjowa7:e jamisi... Bawo lo le ranmilowo? Fi ona Han mi... Je ka mo way. E jor... E Dakun 2 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:33am On Jul 07, 2016 |
The funny thing be say boys don dey old....I know my age! Na around this my age na my dad dey when he marry my momsi....I never even fit take of myself if woman join me...no be die? Our people go just dey suffer dey lock up... wetin this one mean?? 147 Likes 12 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by signature2012(m): 2:00am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer: Guy,what I will just say is,never give up! I remember one time I had only a single Jean,na dis Jean I dey wear daily,this tori don tey small o. One particular day,na so I wear this same Jean,I dey road dey go,something fell for my hand,as I say make I pick am,na so my Jean just dey tear,I just turn am to crazy Jean,but today,things don better,life don change for good,don't rely on any govt but God,so as far life dey,their is hope. 103 Likes 6 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by zeberebe: 4:51am On Jul 07, 2016 |
Izonpikin:tell him 2 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by zeberebe: 4:53am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:lol 1 Like 1 Share |
Re: Nigeria has finished me!! by Amberon: 4:59am On Jul 07, 2016 |
I like your anger. Every Nigerian should be furious. Then and only then can there be a revolution. 108 Likes 6 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 6:13am On Jul 07, 2016 |
as much as the op is hilarious, sadly this is the reality most Nigerians are facing today. since the beginning of this month, I have been thinking about life after NYSC, as per job hunting. I believe what will be will be. 19 Likes 1 Share |
Re: Nigeria has finished me!! by freeage7(m): 6:31am On Jul 07, 2016 |
Op u say u dey vex? Na play u dey, I vex pass u oo, no just go there...Nigeria don finish oo, we just dey deceive ourselves dey carry on. Imagine inside June, I no see light up to 2hrs put together, PHCN dey give me bill of 12k shuoooo! Bubu say make we get patience, but I ask, does it need to get so bad before it get better...the most daunting task now, na how I won take secure the future of my kids inside this harsh economy...country wey 3 course meal no sure...God punish our leaders both past and present. 58 Likes 9 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 7:08am On Jul 07, 2016 |
Ee come be like say everything for this country dey harsh, mosquitoes come harsh pass. No insecticide dey kill them again, abi dem don mutate come develope resistance for insecticide. I don spray tire, pour snipper sotey na me the snipper wan come kill. To breathe na wahala, still mosquitoes dey bite, sulk and even chew. The other day I no sabi as rat take run enter my kitchen. I no even border myself to look for am. I just secure my certificate them because I know say if hunger finish with am for that my kitchen, the next thing him go do na to dey find my certificate. This morning, na so I see the rat lie down for my kitchen. I been think say him don die until I notice say him dey breath small small and dey blink him eyes. I just use broom sweep the thing comot. The huzzling is real! 434 Likes 75 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:15am On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko: oboy, you go try hands on comedy oh.. bovi gat nothing on you oh... 112 Likes 11 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:16am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer: prince akpabio? 1 Like |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:20am On Jul 07, 2016 |
Teespice: what will be will be....some people even change am to "what gonna be gonna be".. all that na still part of the e go better wey we dey talk... but nobody dey talk HOW e go better or WHEN e go better.... You no suppose to stress yourself na....last last, just package yourself, do shakara, one rich bobo go come marry you...you don change to big woman be that na....abi? 52 Likes 2 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:22am On Jul 07, 2016 |
Anticorruption:Nah... |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:23am On Jul 07, 2016 |
signature2012: e go better abi?? 20 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Almajiri1: 7:24am On Jul 07, 2016 |
This holy anger needs to be felt on the streets of Nigeria revolution wise. 34 Likes 1 Share |
Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 7:25am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer: Na for harsh times na him talent dey come out oo. The most amazing talents are born out of hunger and survival instincts. Me self don dey try nuture other talents, I don dey discover say I get small ability to control my dream, like say na script me dey write and act am at the same time. Anytime hunger too wire me, I wash my plate and spoon, keep am under my pillow and sleep off. When I land for dream, food go show! I come extend this my talent to robbing banks in the dream. I don rob almost all Nigerian banks even cbn for dream; the problem be say the money no dey gree follow me wake up. I still dey work on perfecting this my skill. Who knows, one day I can be able to drag my stolen wealth from dream to my bed side. 240 Likes 45 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by ArodeTsolaye: 7:30am On Jul 07, 2016 |
Almajiri1: nigerian wey get coward blood? According to fela Den go say- 'I no wan die, I no wan quench, I get one child" People wey God don curse with cowardice. 47 Likes 4 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:33am On Jul 07, 2016 |
ArodeTsolaye:nawa oo 8 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:33am On Jul 07, 2016 |
ArodeTsolaye:nawa oo 1 Like |
Re: Nigeria has finished me!! by megawax8: 7:41am On Jul 07, 2016 |
Lalasticlala, come and see interesting FP topic. ' A frustrated Nairalander vents' . But op, its really annoying, that is, the state of the nation presently. 7 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Almajiri1: 7:44am On Jul 07, 2016 |
ArodeTsolaye:If they fail to fight for their collective good,the law of natural selection expressly comes into play like tis happening. Strictly survival of the strongest. 12 Likes 2 Shares |
Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 7:55am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer: and if that happens, your kind will call me a liability and a gold digger. last time I checked, nobody wants to be attached to a liability. your line of reasoning sef leaves so much to be desired. 19 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by otokx(m): 7:56am On Jul 07, 2016 |
Some guys go to building sites and get labour work to keep body and soul together, others join cleaning companies and get paid 20k a month just to survive. Driving work is also available for those of sound mind, high personal hygiene and dedication. Security jobs nko These are just to mention a few. 6 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 8:01am On Jul 07, 2016 |
Enhen! Dem don dey shout make dem carry thread go front-page. Person no fit do small complain, next thing dem don carry am put make the whole world see say u dey complain. We too like aproko and amebo for this country. 38 Likes |
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:04am On Jul 07, 2016 |
Teespice: No vex..I just dey talk am say e dey do me... Nobody get monopoly to the streets oh..you are very much welcome... e get one small girl for my area...she jes get belly for area..small girl of about 20...nobody know who give am belly, as she just born, she carry the pikin she her Mumçy...as I dey type so, the girl dey Spain.. she just use leg follow some guys move.. the reason I dey tell u this e say, girls even dey hustle pass guys dese days... 45 Likes 1 Share |
Re: Nigeria has finished me!! by HIGHESTPOPORI(m): 8:07am On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:You funny pass Bovi,try Comedy 4 Likes |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (118) (Reply)
Abba Kyari Is Dead! / Nigeria: The Good, The Bad, The Beautiful, The Ugly. / 2019 Presidential Election Results Announcement By Mahmood Yakubu, INEC Chairman
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 94 |