Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,201,337 members, 7,978,081 topics. Date: Thursday, 17 October 2024 at 06:33 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? (1982 Views)
Pastor Adeboye Apologises For Saying You Won't Make Heaven For Not Paying Tithe / Angela Nwosu: 'Don't Want To Make Heaven If It's Where Oyedepo, Adeboye Will Go' / Egyptians Are Yet To Dispute The Parting Of The Red Sea. Our God Lives! (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 6:11pm On Mar 04, 2021 |
kingxsamz: Bros, Person way Sabi give names to things, wey Sabi work, wey like woman, e don Already Know good and bad. For e know say Work Good, therefore e know say "No Work dey Bad"! He gave names to things d4 e know say to identify things dey Good so dat e no go make mistake. Therefore, e know say to make Mistake dey Bad. E no say Woman dey Good, therefore e know say "Konji na bad thing" As you can see They Surely knew "Good and Bad"! My guy just reverse! Road No dey here! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 6:23pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: Lmao... You dey point out these things dey laugh , shey you no know say you dey prove my point? You no know say you dey prove my point say your bible dey contradict it self? Your bible talk say dem no know good and bad before eating the fruit. Na still your bible talk say Adam know good and bad. Which one person go con believe? E be like say you no really sabi this your bible wey you dey read so o. . I know your next move. You go make another excuse talk say na hidden context, or na hyperbole abi na symbolic meaning. Or your classic excuse. "You need the holy spirit to understand" @bolded, shey your bible talk am abi e no talk am?
|
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 6:29pm On Mar 04, 2021 |
kingxsamz: Nna, e no dey any where for Bible (KJV) wey e talk say "dem no know good and bad" even Satan bible no contain am! Bros, broosu, No Road! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 6:40pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: Bro this road you're going won't favor you o. How many of your colleagues go gree with this your personal opinion? Okay, make I ask you two questions. Why is it called tree of knowledge of good and evil? Why did they realize that they were naked after eating the fruit, since you don talk say dem already know good and bad before eating the fruit? Okay, bible no contain am abi? Okay make I drop verse. E talk am abi e no talk am?
|
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 6:55pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: Oh is this what you'll do? Keep exposing yourself |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 6:56pm On Mar 04, 2021 |
kingxsamz: God is NOT omnipotent lol if you read the Bible..Christians gave him that grand label |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 7:02pm On Mar 04, 2021 |
1Sharon: True... But they refuse to see the obvious contradictions. 1 Like |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 7:04pm On Mar 04, 2021 |
1Sharon: He's the type who makes excuses for genocide and killing of babies in the bible. So don't be surprised when he makes such comparison. 1 Like |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by sonmvayina(m): 7:06pm On Mar 04, 2021 |
God lives everywhere....God is everywhere, He is just hiding in the least place you will ever look to find him. In Man. 1 Like
|
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:48pm On Mar 04, 2021 |
kingxsamz: Bros, dem no join our head oh, so each of us go get e own view as dia eye take dey work. kingxsamz: Bros you say 2 questions but dis one na 3 questions and na anoda long talk wey you want make I talk dis night on top d one I don talk today. Abeg, tomorrow go soon come, besides we don travel well-well comot from wetin we dey talk about before, so raise fresh thread tomorrow, den our match go start |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:48pm On Mar 04, 2021 |
kingxsamz: Bros, dem no join our head oh, so each of us go get e own view as dia eye take dey work. kingxsamz: Bros you say 2 questions but dis one na 3 questions and na anoda long talk wey you want make I talk dis night on top d one I don talk today. Abeg, tomorrow go soon come, besides we don travel well-well comot from wetin we dey talk about before, so raise fresh thread tomorrow, den our match go start |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:09pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: If you no get point just say so. Na simple question I ask, but you want make I open thread make you type epistle. Funny guy. Shame no gree you give straightforward answer. it is well. 1 Like |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 9:33pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: Na who make this people dem, no be the god? Why him make jaga jaga people? 1 Like |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:54pm On Mar 04, 2021 |
LordReed: The same perfect God wey dey see the future o. Lmao. These guys be making their god look weak fr. 2 Likes |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 10:16pm On Mar 04, 2021 |
sonmvayina: Lol thought you were jewish |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Nobody: 11:01pm On Mar 04, 2021 |
Dtruthspeaker: Wetin you wan talk about religion wey HellVictorinho never hear before? E be like say u don dey do too much. Small thing,you don dey talk too much. FEEEEEMMMMM!!!!!!!!!!! 2 Likes |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 6:26am On Mar 05, 2021 |
kingxsamz: Had a conversation with some JWs yesterday and they started saying I was blaming their god. Hey, who created things the way they are? |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:12am On Mar 05, 2021 |
LordReed: Torch wey no dey work, no go enter market. Moto wey no move, go still dey factory. "And God saw every thing that He had made was VERY GOOD, (not just good oh but VERY GOOD)" And The People wey dey With Him dat time, Dem even Follow Am make every Thing, Dem too Confirm say "It was Very Good". So, bros Torch wey work for market, if e no work for house after yime don pass Nna NA YOU SPOIL AM! So leave Matta for Martins! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 8:25am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: You never hear of factory defect before? |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:27am On Mar 05, 2021 |
HellVictorinho: Bros, I be Mr Doubting Thomas, I no dey gree anything wey I No see for Nature. Eg That nonsense supposed maths question: 1 egg boils at 7 minutes, 2 eggs shall boil at? Den come talk say the answer na d same 7 minutes. Bros, I no gree! I no ever write d same 7 minutes, I agree to fail.am dan for anybody to deceive me for wetin me I don see and I get small sense enough to know say E No True. My Answer be say E no go ever be d same 7 minutes Lai Lai, d increased no of eggs must change d time, even if na small, but make nobody tell me say na d same 7minutes, I no go ever gree! So now I don understand Evidence and how to find d Natural Evidence, na im make me dey talk d kain thing wey you never hear before. And when person know say dis world people Sabi Lie, Lie, den person must turn Detective to Uncover that which is True! So, na so I don be now and now from dere I dey talk. |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Nobody: 8:31am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: Actually, I don hear talk wey dey related to religion before. You,LordReed and budaatum dey talk about wetin dey inside Bible the other time. Wetin remain? |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:45am On Mar 05, 2021 |
LordReed: Bros,.Na una do factory defects as una don defect una-self as A diseased Corn Seed Must Produce Diseased Products! As Dare Alade take sing, "Na your fault be dat"! No Road here, bros! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:49am On Mar 05, 2021 |
kingxsamz: You dey Fear! Open fresh Thread make the issue for clear! We don too disturb dis op nonsense thread! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 8:52am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: Potter make pot, the pot get hole you say na pot get the fault, no be potter wey make pot with hole we go blame? |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by sonmvayina(m): 9:06am On Mar 05, 2021 |
1Sharon: Lol....Noo oh, i just stated that the jewish beliefs are very similar to the Igbo odinani. I just quote the jewish scripture because that is what people are conversant with.... |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 9:39am On Mar 05, 2021 |
LordReed: Wen Potter finish the pot, hole no dey, if not you no go carry d pot go house! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:44am On Mar 05, 2021 |
LordReed: I just tire. 1 Like |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:45am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: Lol, fear ko. Abi na you dey fear to answer simple question. You dey find thread to type epistle. |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 9:53am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: So pot fit put hole for hinsef? |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 10:32am On Mar 05, 2021 |
LordReed: Once Pot carry e-self go house, Na im Must to spoil e-self when e spoil! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 10:35am On Mar 05, 2021 |
kingxsamz: i need space make I blow you well-well, make you fly comot! I no want ring, I want stadium with lights, camera and spectators! |
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 11:29am On Mar 05, 2021 |
Dtruthspeaker: Person wey make pot come put am where the pot fit fall break, na him we go blame. 1 Like |
Where Was God Living Before He Made Heaven And Earth? / Talkinq About Nick Vujicic? / God: An Atheist Perspective
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 69 |