Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,742 members, 7,882,550 topics. Date: Sunday, 07 July 2024 at 08:32 AM

Serious MATA Don Land O! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Serious MATA Don Land O! (1814 Views)

Mata Sunada Wasu Sinadarai Na Sirri Guda 30 / Abeg I Need Nairalanders To Jugde Ds Mata Oo / Make Una Help Me Chuk Mouth 4 Dis Mata O. E Fit Happen 2u. (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Serious MATA Don Land O! by dotcomnamename: 11:15pm On Dec 09, 2012
SERIOUS MATA DON LAND O,

E GET DIS LADY HER NAME NA SHOLA,SHE DON MARRY 4 SIX YEARS AND SHE NEVA BORN PIKIN 4 HER HUSBAND.

SO DEY SEND HER HUSBAND GO ABUJA MAK HE GO WORK 4 3WEEKS.

SO ONE OF D DAYS NA SO SHOLA FRIEND INVITE HER SAY MAKE DEM GO PARTY TOGETHER,B4 DEM COMOT 4 D PARTY TYME DON GO, SO SHE CON GO SLEEP 4 HOTEL CON MEET HER FORMAL

BOYFRIEND DEM CON AGREE TO SLEEP FOR THE SAME ROOM, AS PER D HOTEL NO GET EXTRA ROOM WEY SHOLA GO FIT PAY 4.

AS DEM DEY TOGETHER, DEM SHARE LOVE TOGETHER, NA SO SOLA FIND OUT SAY SHE DON GET BELLE AND SHE NO SAY NO BE HER HUSBAND GET D BELLE, NOW SHE DEY CONFUSE SAY MAKE SHE COMOT D BELLE, BUT EVERY MEMBER OF HER FAMILY SAY MAK SHE KEEP AM.

ABEG HELP ME ADVICE HER WETIN SHE FIT DO ?
Re: Serious MATA Don Land O! by jhydebaba(m): 11:47pm On Dec 09, 2012
Na serious mata be dis oh, infact hen, na serious gbege.
My advice be say make she drink soda before her husband come back oh.
Re: Serious MATA Don Land O! by Nobody: 7:31am On Dec 10, 2012
This wan na big mata ooo, but e beta make she kip d pikin oo.
Re: Serious MATA Don Land O! by AtheistD(m): 7:58am On Dec 10, 2012
Wizee: This wan na big mata ooo, but e beta make she kip d pikin oo.

Keep it R u sure? I bet she planned it.
Re: Serious MATA Don Land O! by 190: 7:58am On Dec 10, 2012
Wizee: This wan na big mata ooo, but e beta make she kip d pikin oo.


^but why she go keep am na,
you nor know say kasala fit burst and yawa go gass for her head if her husband show back
see say belle don enter angry
Re: Serious MATA Don Land O! by Beync(f): 8:07am On Dec 10, 2012
This one no be small thin o
so her husband no well since
Re: Serious MATA Don Land O! by jhydebaba(m): 8:44am On Dec 10, 2012
Beync: This one no be small thin o
so her husband no well since
leave mata for mataias joor.
Re: Serious MATA Don Land O! by 190: 9:33am On Dec 10, 2012
So how she wan do now!
abi she go born am begin beg the man later
Re: Serious MATA Don Land O! by 190: 9:33am On Dec 10, 2012
Beync: This one no be small thin o
so her husband no well since


sprinkles holy water undecided undecided
Re: Serious MATA Don Land O! by Nobody: 9:40am On Dec 10, 2012
Rubbish.
Re: Serious MATA Don Land O! by Dopefiend(m): 9:45am On Dec 10, 2012
Omo dis na serious gbege o. If she abort am ehn baba God fit vex for her say u wey I use anoda man bless u,u feel say u fit jst flush am out abi.on d oda hand,dat mean say d man no well al ds while. D man fit jst undastnd to mk hin wife hapy bt anytime wey he see d pikin na so hin heart go be like say dem use knife pierce am...bt he go get ova am
Re: Serious MATA Don Land O! by Ucheosefoh(m): 9:51am On Dec 10, 2012
What is the name of this movie e be like say e go de interesting 2 watch
Re: Serious MATA Don Land O! by 190: 9:57am On Dec 10, 2012
Dopefiend: Omo dis na serious gbege o. If she abort am ehn baba God fit vex for her say u wey I use anoda man bless u,u feel say u fit jst flush am out abi.on d oda hand,dat mean say d man no well al ds while. D man fit jst undastnd to mk hin wife hapy bt anytime wey he see d pikin na so hin heart go be like say dem use knife pierce am...bt he go get ova am


so wetin you advice because this issue fit cause world war 3 for sapele oh angry
Re: Serious MATA Don Land O! by Dopefiend(m): 10:15am On Dec 10, 2012
190:


so wetin you advice because this issue fit cause world war 3 for sapele oh angry

Dopefiend: Omo dis na serious gbege o. If she abort am ehn baba God fit vex for her say u wey I use anoda man bless u,u feel say u fit jst flush am out abi.on d oda hand,dat mean say d man no well al ds while. D man fit jst undastnd to mk hin wife hapy bt anytime wey he see d pikin na so hin heart go be like say dem use knife pierce am... bt he go get ova am

Btw, shey na chico ejiro abi na teco benson produce dis movie
Re: Serious MATA Don Land O! by Beync(f): 10:28am On Dec 10, 2012
190:


sprinkles holy water undecided undecided
you'll soon run of water
make u no go check whether u too well so tongue
Re: Serious MATA Don Land O! by eunisam: 10:47am On Dec 10, 2012
You shall not kill.even mosquito!
Re: Serious MATA Don Land O! by Nobody: 11:07am On Dec 10, 2012
well this one resemble one super story
wey me watch when i dey for college then
don forget the title of the movie sef grin grin
Re: Serious MATA Don Land O! by 190: 11:14am On Dec 10, 2012
Beync: you'll soon run of water
make u no go check whether u too well so tongue

angry angry
Re: Serious MATA Don Land O! by Beync(f): 12:34pm On Dec 10, 2012
jhydebaba: leave mata for mataias joor.
mmm jide, i no no say u dey here. wetin u advice make d woman do if na u give am d belle?



190:

angry angry
undecided
Re: Serious MATA Don Land O! by fairygeh(f): 12:42pm On Dec 10, 2012
This one na nice nollywood story o,how much be the script?
Re: Serious MATA Don Land O! by prettiest1(f): 3:30pm On Dec 10, 2012
dis na serious mata.
make she keep the belle ooo
God don butter her bread be that na.


which kind tory be dis sef?
Re: Serious MATA Don Land O! by Nobody: 4:06pm On Dec 10, 2012
Please speak english!
Re: Serious MATA Don Land O! by dotcomnamename: 5:28pm On Dec 10, 2012
AmBeautiful: Please speak english!

ENGLISH! cheesy
Re: Serious MATA Don Land O! by chikeorji123(m): 5:47pm On Dec 10, 2012
Haba chei! na v.l.p gbesee oo! be this o abort ke? no even try am o! u wan upgrade baba GOD anoyance be that na chei! l no even sabi wetin l talk..'laying my hand on chest'..
Re: Serious MATA Don Land O! by Goldieluks: 5:53pm On Dec 10, 2012
Abeg i no fit give any kind advise, the matter big pass me.
Re: Serious MATA Don Land O! by mskata(m): 6:10pm On Dec 10, 2012
All this kind gehs wey we get 4 ds country sef,...
Marriage no mean anytn to dem again jes dey spread leg anyhow like blue band
Re: Serious MATA Don Land O! by shakesy(m): 6:29pm On Dec 10, 2012
This matter na small thing naw,in fact it is very very easy,yoruba adage talk say;something wey bin no strong pass banana peson no dey take AK47 kill am,the woman should just take the smallest to the biggest of her things and leave the house before the man returns because she has officially resingned from the wedding in order to be with the ex-boyfriend till death do them part...... no be me talk am o[color=#000099][/color]
Re: Serious MATA Don Land O! by jhydebaba(m): 9:57pm On Dec 10, 2012
Beync: mmm jide, i no no say u dey here. wetin u advice make d woman do if na u give am d belle?



undecided
1st to comment, did u miss dat
Re: Serious MATA Don Land O! by Nobody: 3:32pm On Dec 11, 2012
Things by moonlight. Can't see no moonlight cool.
Re: Serious MATA Don Land O! by deshclones(m): 4:58pm On Dec 11, 2012
As a grow older...I begin to understand the adage that says" A man should not consider himself blessed until He is married"...women are something else...same way some dude was complaining that his ex named her first son after him..Lawd hv mercy...
Re: Serious MATA Don Land O! by dmcdad: 5:24pm On Dec 11, 2012
sexkillz: Rubbish.
Another home video.. B4 una run dy comment, make una check the authenticity of the post. Read between the lines and u'll smell a rat
Re: Serious MATA Don Land O! by Dopefiend(m): 6:50pm On Dec 11, 2012
dmcdad:
Another home video.. B4 una run dy comment, make una check the authenticity of the post. Read between the lines and u'll smell a rat

Na goat I smell embarassed

(1) (2) (Reply)

One Word For This Couple / What ''weight'' Would You Consider Ok? Ladies/guys / Dearest Future Husband

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 29
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.