Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,177,953 members, 7,903,064 topics. Date: Saturday, 27 July 2024 at 11:36 PM

Vidic Dey Happy With Man U Swagga - European Football (EPL, UEFA, La Liga) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Vidic Dey Happy With Man U Swagga (464 Views)

Diego Lopez Punch On Vidic's Face Worse Than Nani's Collussion With Arbeloa / Nemanja Vidic Out For Two Months After Knee Surgery / Robin Van Persie Signs With Man. United ( Picture) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Vidic Dey Happy With Man U Swagga by Livermeka: 11:35am On Dec 26, 2012
Vidic dey happy with Man U swagga
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121226/Vidic_dey_happy_with_Man_U_swagga


Manchesta United Kaptin Nemanja Vidic bilif say dem go ball wella for dis Krismas time as per players dem injuri don dey hil.
United go play Newscatle for Wenesday even as City don reduce d gap wey United gif dem to jus 4 point, dem go still nack head wit West Brom dem before dem waka go jam Wigan for Januari 1.

Becos of d way match buku, Vidic wey jus come back from injuri wahala wen dem draw 1-1 wit Swansea sabi say e go good to get team wey dey kampe,

Rio Ferdinad go dey, Kagawa sef go start to train afta im leg wahala, and na only Rafael da Silva, Nani and Anderson wey dey dem injuri list.

Vidic fil say as players dey come back e go helep d team as pipul go dey to cova evriwhere even as dem dey try make dem hold d numba 1 position wey dem dey as we dey enta 2013 so.

" We go play 3 match inside 9 days, we get players wey dey come bak and e good for us for dis kain time" Vidic talk

Newcastle bin reduce Coachi Alan Pardew wahala as dem manage win onli dier secon match inside 12 match wey dem play, as dem beat QPR 1-0 come cari 5 point comot for relagation wahala

Ferguson tire as im no undastand d way Newcastle fall yakaataa for table bottom, and na d same way im shok as dem bin dey fight to take qualify for Champion Lig las year so.

Ferguson talk say Newcastle impree am wit d kain fine fine player wey dem dey sign

" I sabi Demba Ba before, but i no go lie, i bin no sabi who Yohan Cabaye b, even Papiss Cisse sef i no know, i no go lie, maybe na d injuri wey dey wori dem make dem defom

" Cabaye no go dey till next yeat, Cheick Tiote sef no go fit play till we enta New Year and e don affect dem becos dem no get big big team like City abi Chelsea get.

Gabriel Obertan sef don dey rub hand dey jolly as im dey go back to Old Trafford, Im wan impress im Coachi make e find shirt for the pipul wey go start match, afta im bin recova from d injuri wey dey wori am.

Obertan no too shine dat time im dey for Ferguson and na onli 13 time e play for dere for d 2 years wey im spend, before im waka go Newscatle for August 2011.

"Na spesial tin to waka go bak to pesin foma klub, i get plenti paddi dem for dat side, e bin dey one kind wen i bin fess go bak dere, but i don use to am no, na d 3 point we wan chop for dere.

" E get d kain way pesi dey feel if im go play im foma team, na d same tin wey hapin wen i bin dey Bordeaux.

Obertan wey enta field foe secon haff for d match wey dem play QPR dey feel say d win sef no too make sense like dat.

" Afta wetin we don lass yeah, pipul dey expet say we go do pass, we sabi say na to scatta bodi for Old Trafford if we wan kollect anytin for dere. Pressure stil dey sef, d win wey we win QPR no b anytin


© supersport.com

(1) (Reply)

Clubs On Red Alert As Guardiola Reveals He Is Now Ready To Return To Management / Southampton 3 Vs Manchester City 1 / Sir Alex Ferguson: Irreplaceable Mourinho Could Stay At Real Madrid

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.