Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,197,662 members, 7,965,523 topics. Date: Thursday, 03 October 2024 at 03:25 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (43274 Views)
Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (Reply) (Go Down)
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Akanniade(m): 8:02pm On Dec 03, 2009 |
Instead food go waste make belle burst |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 10:26am On Dec 06, 2009 |
[size=13pt]Warri which level. . . .this season?, i know say AREA go must surely shake like eathquake ooooo. . . . .see grooving! [/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igboboy1(m): 9:09pm On Dec 07, 2009 |
O boy dem dey tell pesin? You know na, Me I plan to reach Ekpan/jakpa Area as na im I base. Of cos cant forget bendel estate side, Enerhen, Airport, Effurun all the way to Ovwie Aladja for DSC side |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by littlecaf(m): 2:09pm On Dec 29, 2009 |
area i hail all of una way make thing esay here una too much i be confirm warri too i start this thread 4rom page 1 but since my mind no go ther and i no believe say e go big like this but a t time no ti be,cus if you look you time now e and my onw no be the same i hail everybody 4ro okumagba layout ejeba apala ogborokoko sch domdomigoss efffurm |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by naso2(m): 6:41pm On Jan 04, 2010 |
Area ,Area Man wey marry hunch back na im go calculate how him go dey do the thing. Person wey laff so teh e fall for ground, no be say laff dey fall person na say ground dey hungry am before Boy wey say him mama no fine ,na style him dey take talk say him papa no get eye. |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 9:58pm On Jan 07, 2010 |
[size=13pt]warri nothing do us . . . . . .! , we get level pass as dem dey think jare. i hail you guys out there from the big heart of the wafi city. keep doing your real things as usual. [/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 2:54am On Jan 14, 2010 |
AREA!! I dey hail o!! My brother Chris!! Happy nu year bros!! My advice for all man this yaer na to structure theirslef, compose well make things no leave you go. You know say bread wey no get label na ehn dem dey mistake for ajegunle bread. No matter how NDLEA vex reach, Igbo can never carry NAFDAC number. Make una dey well and wash properly. |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 12:11pm On Jan 15, 2010 |
[size=13pt]Na true word bi that. . . .my man , nothing do you!!.well, i dey trowel hailings. [/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by adagz01(m): 9:22pm On Jan 19, 2010 |
AREA! AREA!! AREA!!! wafi una 2 much ooo i nor b no say this kind of night of a thousand laff dey 4 moneyland ooo.eh i dey miss since o.anyway i b confirm safi guy sha. wafi nor dey carry last if e worse wewe nar kukuma draw. |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 9:45am On Jan 20, 2010 |
[size=13pt]adagz 01 u dey warri now. . . . i dey warri now i won go church this morning[/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by adagz01(m): 10:25am On Jan 20, 2010 |
@ogaga4luv,i dey safi dey do my tin tweletwele.anyway noffin do u my bro |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Rapmoney(m): 2:14pm On Jan 20, 2010 |
Area i hail all of una well well oh, me sef just dey do am for here tweletwele, dem say man wen nor get money na im dey say beer dey bitter |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by adagz01(m): 8:33pm On Jan 20, 2010 |
i nor fit shout ooo, them say rat wen go theif sardine e go talk as e go tek open am |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 3:36pm On Feb 10, 2010 |
;d ;d ;d ;d |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ekpekus(m): 10:48am On Feb 18, 2010 |
I lyk dis kin topic! Warfi proper. Okpolo no b open eye o, abi u fink say big head na 2 knw book. |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 2:37pm On Feb 22, 2010 |
[size=13pt]Well ill be there for the drinks! , i feel you my man. . . . [/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by ifihearam: 10:23am On Mar 01, 2010 |
Shwooooo Una for clear me say the parade dey this gran na. Na frustration make engineering student go do IT for police station Na packaging make plantain chips dere pass kpekere If you tell Ogoro man(palm wine tapper) say him pami sweet e o say u nor test yesterday own Na original pele guy dey yan o,una know say na sapele colonize warri cha,so make una loyal sharp sharp |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 4:14pm On Mar 01, 2010 |
ifihearam: |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chinesedoll(f): 7:42pm On Mar 02, 2010 |
ifihearam: DEATH!! |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igboboy1(m): 1:02pm On Mar 03, 2010 |
Ekpekus: bros yes o, okpolo eye na tear eye. O boy see flexin wey i wan do this weekend for ekpan (thanksgiving), yes o na my money kill am, |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by ifihearam: 12:25pm On Mar 09, 2010 |
Which level na Una dey fall my hand O bob breast wey dey mouth better pass the millions wey dey brassier cha Gidigidi dey tear pant oooo Nor be who first reach police station dey win case cha |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by ifihearam: 12:27pm On Mar 09, 2010 |
Instead food go waste make belle burst NOoooooooooooooooo Na instead of beer to waste make BELLE BURST OOO |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 6:56am On Mar 13, 2010 |
[size=13pt]----------- [/size] ifihearam: |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Woke4all(m): 4:37pm On Mar 19, 2010 |
Area! Area!! Area!!! Krrrrrrrrrrrrrrrrr gbo gbo gbo gbo, I dey troway gunshot. Man need hold he penis for piss to get direction. Na brain dem dey take cure boil for brokos. Dem no dey use brokos take test odechi Òoo. Behind every hungry kokoroko there's a woman foul. Abeg make una firedown, |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 11:49am On Mar 20, 2010 |
[size=13pt]You be real CORRECT WAFERIAN. . . . . abeg gimme more of this stuff. mmm , the slangs full your side remain. [/size] |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Woke4all(m): 3:42pm On Mar 21, 2010 |
Daddy get big belle no mean say he dey pregnant and no be anybody wey get red eye smoke igbo. |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 3:48pm On Mar 21, 2010 |
[size=13pt]bu ha ha ha --- , this is so heavy and too funny to read . . man , i cant just stop laughing !! .bico , ememera here . u too much. . . bring them more!!!! [/size] Woke4all: |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Woke4all(m): 5:14pm On Mar 21, 2010 |
Hailingssss, |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Rapmoney(m): 3:26pm On Mar 22, 2010 |
Area i hail all of una again Oh, Dem say snake wey talk say na tortoise back e won bite na toothache go kill am |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by biina: 11:03pm On Mar 22, 2010 |
Nothin dey fear! No matter the weight of elephant, e no fit cause earthquake. Monkey smart, monkey smart; na tree near tree Person wey thief fowl for morning, fit thief person for night |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Dracula27: 9:19am On Jul 10, 2010 |
Big head no be senior, Okpolo no be open eye. (soldiers) Consultation no be confussion, Noting dey happen, nothing dey happen na him dey kill native doctor pikin |
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by dfav: 3:31pm On Aug 05, 2010 |
na winch dey worri u? thats a question which means if u are bewitched? |
(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (Reply)
Ooni Of Ife Reveals Himself After Going Into Seclusion For 7 Days In Osun. Photo / A Database Of Traditional Igbo Names / Highlighting Two Igbo Deities And Their Significance To Their Followers (Pics)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 25 |