Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,348 members, 7,881,286 topics. Date: Friday, 05 July 2024 at 03:54 PM

Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English (1544 Views)

Recession Bawo! Check This Out!!! / That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by Nobody: 4:50pm On Aug 31, 2015
BAWO AND TOSAN (True life Story) Tosan and Bawo dey date when dem dey SS 2. When dem finish school, dem cum write Jamb after WAEC. By the time results come out, Bawo make am but mathematics cum cut Tosan. During when Bawo dey process e admission nai e papa die. And e mama nor too get. Little money wey Tosan dey get from her parents, she dey use am support Bawo education. Na when Bawo graduate nai Tosan for cum make e mathematics. Bawo cum get job for one construction company. He rent house, gather money nai e marry Tosan. Though dem both don agree say Tosan go do part time. The following year nai she get belle. God cum bless dem with a son. Becos say their mouths don increase, Tosan cum say make she wait small cos money nor too dey for her school. And to avoid being idle, she cum dey go market go buy corn dey roast for front of their compound. One day wey she dey her stand dey peel corn, nai one jeep park for her front. The driver cum tell her say nor be corn e wan buy. But na the first time e dey see her so. And e like to make her e friend. Tosan cum tell am say she nor go fit be e friend cos she don marry whether the man nor dey see ring for her finger and baby for her back? The man cum laff say make she nor worry. Say e ready to buy her car if she ready to be e lady. E cum tell Tosan say e name na Dr Kenneth and na him get Emacok Drilling Line. She know the company but she norva see the owner. The man cum give her e complimentary card say if she make up her mind, make she call am. Na so e take drive go. When she reach house, she nor fit tell her husband. But in the night when Bawo wake up say e dey go piss, e see her sidon for the bed, put hand for jaw dey think. When e persuade her to talk, she cum tell am everything wey happen between she and Dr Kenneth. The husband cum say make she nor worry say make she just forget. Two weeks later, Bawo cum dey get problem for e working place. E come house one day nai e ask Tosan whether Dr Kenneth still dey come meet her? She say yes. Nai e cum tell her say make she beg am to give him work. The following day nai she really beg am but Dr Kenneth say na under the condition say e go sleep with her but e nor go date her cos e know say she love her husband wella. Tosan nor fit tell her husband. Na when Bawo don disturb her taya nai she open up. Na that day Bawo for nor talk again. The next month nai dem kidnap the man wey get the company where Bawo for dey work. By the time dem release the man, e money don less. The company cum dey owe workers. Bawo don find work for other places but no hope. Things cum dey very rough by the time their second child come. One night nai Bawo for wake Tosan. Kneel down for her front begin dey beg her "My wife, I know say I marry you as a virgin. I know say you norva know any other man since you know me. You know wetin we dey go through for this house. I beg, just do it for our love. Our family. Our kids. And do it for us." By now, her eyes don dey open to hear wetin Bawo wan talk. "Just let am sleep with you make e for give me job for e company" As e talk the words, na so e drop e head begin cry. "When frustration don hit man, e ready to do anything to get money" She nor fit talk. She just fold her hands across her chest. Water just dey pour.... The next day, Tosan dey front of Dr Kenneth office dey wait make the door open. The secretary cum take her enter the office. Na there she dey till everybody go break. Dr Kenneth cum take her enter e office, lock door. He cum dey remove the button from e suit. Tosan cum drop the CV for table, she cum dey pull her wedding ring. Where she for dey pull am, nai she burst cry. She turn back towards the door. Dr Kenneth cum rush stop her. She just dey cry. "I nor wan do this. I love my husband. I can't do this..." Sympathetically, Dr Kenneth cum calm her down nai e tell her say make she go. Say e go give her husband work when e don go through the CV. E cum even give her some money for transport. When she reach house, she cum tell her husband everything. Both of dem cum dey happy. Na that week Bawo start work. In 16 months time, dem cum build house buy cars and get enough money. Tosan cum say if she born her 3rd child nai she go ready to go school. Where trouble dey sleep, yanga dey go wake am. Bawo cum dey friend one of their cleaners for office. The news cum blow enter Tosan ear. One evening, as e just dey drive enter e compound, nai pregnant Tosan for stop am start to attack am with question. The thing cum lead to serious quarrel. Bawo dey say e be man and e get right to sleep with anybody wey e like. Abi when e own oga dey sleep with her, e talk? Tosan clean her ears asking, "Who dey sleep with me? Your oga sleep with me?" Na there she for grab Bawo shirt dey push am dey cry say why e go talk like that? Whether she nor tell am the truth? Say Dr Kenneth nor touch her" But Bawo still dey shout dey call her ashewo. Say e just quiet but e nor fit tolerate am again" so, make she leave am make e Bleep who e like. Na there dem cum dey fight. Bawo cum dey beat her till their tenant rush cum separate dem carry Tosan go hospital. Na doctor confirm say she lost the belle. From hospital nai Bawo carry Tosan with the two children go Tosan family compound say e nor marry again. Like play, dem cum separate. Bawo cum carry the babe wey e dey friend cum dey stay with am. Tosan with her two children cum dey stay with her mum cos by then, her dad don die. One day when Tosan go market go buy foodstuffs, rain come meet her. As she dey co
Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by Nobody: 4:51pm On Aug 31, 2015
rain come meet her.
As she dey come back, rain cum dey fall
heavily.
She nor carry umbrella. Where she for dey rush to comot from
road enter shade, nai be motor horn wey
dey blar for her front.
The Camry cum park. She notice say na
she the person park for.
When she enter the motor, na Dr Kenneth.
E cum tell her say why she nor carry
motor and she know say na rainy season
we dey?
She breath reach ground.
Na there Dr Kenneth for ask her say wetin dey happen.
Nai she judge full ground.
Where pain the man pass na say, e feel
say e sleep with her whereas e nor sleep
with her.
E cum carry her go drop for house nai e give her 10k.
The next day for work nai e send for
Bawo.
Bawo sidon dey wait make e finish call
wey e dey make.
Dr Kenneth clear e throat, nai e tell Bawo say
"As a man, e easy for you to tell woman
say make she chop grass than for you to
tell your wife say make she sleep with
another man.
Becos of work, you tell your wife make she sleep with me.
But becos I see the love wey she get for
you, I nor doam.
She loved you so much.
And she wanted the best in your
marriage. But you betrayed her.
I don talk with Hannah.
She confirm to me say she dey date you.
Mr Bawo"
E cum stretch envelop for am.
"Meet the finance director as you dey go. You are fired."
All the tears wey Bawo cry nor touch Dr
Kenneth.
Na so e still sack Hannah join.
Bawo dey house for two months, no job.
E cum dey drink. Na so thoughts cum dey trouble am.
In the end, stroke cum doam.
Na that one nai sink all e money.
Dr Kenneth lost e wife 6 months back.
And e get two children wey dey school
abroad. E cum dey ask Tosan hand in marriage.
Now, if na you be Tosan, wetin you go
do?

*Go settle with your husband Bawo.

*Marry Dr Kenneth.

*Stay like that. And if na you be
Bawo, wetin you go do?

*Go beg Tosan back.

*Go beg your boss.

*Stay like that.
Lesson to married women!
Whatever you dey go through for marriage, God dey see you.
Nor let your husband ask or convince or
deceive you to go sleep with somebody
for any favour.
The mouth wey you take agree, nai e go
take judge you. Even if you nor doam, e go put am for
mind say you doam.
And to our youths, who unu blame for the
break down of this marriage?

Bawo.

Tosan.

Dr Kenneth.
We pray make bad situation nor meet us
for life.
Amen.

1 Like

Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by kolatobs(m): 4:53pm On Aug 31, 2015
ok
Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by afolwalex20(m): 5:12pm On Aug 31, 2015
Would have love dis story better of u wrote it in English..


Anyway, tosan should marry Dr kenneth..

(1) (Reply)

Ladies pls Take Note: How Can I Have Sex Without Getting Pregnant? / She Hide These From Me All This Time / 8 Signs Your Girlfriend Has Lost Interest In You

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 40
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.