Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,174,128 members, 7,890,779 topics. Date: Monday, 15 July 2024 at 08:18 PM

5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / 5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall (804 Views)

12 Category Of People You Will Meet In A Bet Shop / Amazing Naija Food Wey You Never Try Before / Men Who Are Afraid Of Using Escalator In Mall (video) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall by sylvesterxyz(f): 2:50am On May 28, 2017
grin cheesy

Lagos na the place where you go meet different people with orishirishi lifestyle. And ladies no dey carry last when dem visit the mall.

1. The Picture Dem Gang

These ones dey enta mall only just to take picture ‘chakam’. Selfies for toilet, restaurant, inside boutique, for studio or any place wey make sense well. So that dem go fit show all their paddy dem for social media.

2. The wannabes Gang

These ones dey enta mall just to form fake accent (Like say na dem sabie speak English pass). Their main objective na to enter mall for impression. And them sabie price? Asin they can so price for Africa. Ehen! Again, dem be oga kpata kpata for window shopping. I give them hand for forming

3. The Official Gang

Awon eleyi, their parents dey get money wella. You no fit see them for everywhere. Anytime dem enter mall, no be for joke, Na for serious business. Maybe to go watch cinema feem! Buy food items, yarn with their frenz, hookup with fresh guys, eat point n kill or take confam expensive drinks to step the thing down.

4. The noise maker Gang

These special type of babes sabie make noise? Na so so talku-talku for mall. Dem go shout/scream when dem just see celebrity for inside mall. When dem dey chop, dem dey disturb, even when people dey watch cinema, dem dey disturb too much. Dem too like ‘notice me’

5.The ‘wakapass’ Gang

These gehz can so dress up, their makeup na die! English people go say “they always look all glammed up” but their wahala is dem sabie waka-waka too much for inside mall, except if one guy wan pay their bills, ask for their contact or wan drop them off with him car. Them go waka from morning till evening until person go come toast them

All Rights Reserved,@ Cheekah Suave more of this from 3naija.com
Re: 5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall by Nobody: 2:53am On May 28, 2017
Hmmm ladies this, ladies that all the time
Re: 5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall by sylvesterxyz(f): 2:57am On May 28, 2017
this ladies are everywhere in the country grin grin grin grin grin
Re: 5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall by BlackDBagba: 2:58am On May 28, 2017
Counter thread loading grin

1 Like

Re: 5 Category Of Babes Wey You Go Meet For Lagos Mall by ikbnice(m): 5:13am On May 28, 2017
Ladies are always the centre of attention. The world revolves around them and they know this.

1 Like

(1) (Reply)

Picture Of A Man Training His Dog On How To Swallow And Steal Money. / See What Happens When You Help A Desperate Yahoo Boy / You Remember This?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.