Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,174,188 members, 7,890,998 topics. Date: Tuesday, 16 July 2024 at 05:36 AM

Bishop T. D. Jakes Don Land Naija - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Bishop T. D. Jakes Don Land Naija (521 Views)

Daddy Freeze Slams Funke Felix Adejumo: Jay Z Insulted T.D Jakes, Still Makes... / Bishop T. D. Jakes Arrives Nigeria For COZA Event. Pics With Biodun Fatoyinbo / Dolapo Osinbajo, Bishop T.D. Jakes And Pastor Paul Adefarasin Pictured Together (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Bishop T. D. Jakes Don Land Naija by NewsinPidgin(f): 5:03pm On Aug 24, 2017
House On The Rock na very vibrant church wey be say dem no dey select people for wey dey attend, anybody from any tribe fit worship dia, with over 7,000 worshippers on Sunday mornings with plenty plenty branches for all over Africa and Europe.

Na Pastor Paul Adefarasin with him wife, Ifeanyi Adefarasin dey head dis church.

People don talk am say if you dey find husband or wife for Naija, House On The Rock na one of d places to go unto say dem get better better men and babes for dia with correct ginger. . .

As at yesterday, dem start one of dia programme wey dem dey do every year wey be "SPIRIT LIFE CONFERENCE" and dem tag dis year own "EMERGE"

And for dis year own, Bishop T. D. Jakes na one of d guest Pastors. Pastor Tudor Bismark, Pastor Wayne Malcolm, Mrs. Funke Felix Adejumo too be guest Pastors for d event.

Pastor Donnie MccLurkin sef go follow dey.

Plenty plenty gospel artistes like Segun Obe, Sonnie Badu, Eno Michael, Beejay Sax, etc go dey sef.D programme start on Wednesday 23rd August and e go end on Sunday 27th August, 2017.

E dey happen for The Rock Cathedral (House On The Rock) wey dey Conoil junction, Lekki-Epe expressway, Lekki, Lagos.

Wetin dey burst people brain na d fact say Bishop T.D. Jakes go dey.

SOURCE: http://newsinpidgin.ng/bishop-t-d-jakes-don-land-naija/

Re: Bishop T. D. Jakes Don Land Naija by LordIsaac(m): 5:04pm On Aug 24, 2017
Lols...ur pidgin is sweet o!
Re: Bishop T. D. Jakes Don Land Naija by NewsinPidgin(f): 5:06pm On Aug 24, 2017
LordIsaac:
Lols...ur pidgin is sweet o!

My broad, thank you o... How we go do na?

1 Like

(1) (Reply)

Spirit And Flesh And Bone / "I Have Found The Dried Up Blood Of Jesus!!!"---christian Lunatic!!! / Bishop Who Said Muslims Have The Right To Islamise Nigeria Featured In A Song

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.