Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,187,346 members, 7,932,265 topics. Date: Monday, 26 August 2024 at 11:10 PM

Which Matter Dem Dey Setttle Now ? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Which Matter Dem Dey Setttle Now ? (740 Views)

Which Matter Are They Settling In Your Area? / Which Matter Dem Dey Settle For Una Side? / Which Matter Dem Dey Setttle Now ? (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Benlivingstone1: 5:55pm On May 28, 2020
Oga see madam wig inside security man room
Na the matter be that
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by ghettokid1(m): 5:59pm On May 28, 2020
Benlivingstone1:
Oga see madam wig inside security man room
Na the matter be that
Make the madam tell oga say 'im give the security man the wig to wash' its not a big deal na
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Nobody: 6:04pm On May 28, 2020
Girlfriend don go delete blockchain app with $5k worth of BTC make she for see space download TikTok. BF no remember password again

Na the matter we dey go settle this evening
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Oluwasaeon(m): 6:09pm On May 28, 2020
Treasurer use church aza pick money. EFCC don carry Daddy G.O, we dey station like dis

3 Likes

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Nobody: 6:23pm On May 28, 2020
Dem carry my guy babe for inside Range my guy come vex spoil the tyre. Na floor we dey for prostrate since. Na the matter we dey try settle since morning

1 Like

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by paulolee(m): 6:28pm On May 28, 2020
hear say angel Gabriel don sell trumpet wey him supposed blow for world to end...we de try gather matter settlers to go settle am
2..motor jam who de go settle matter and dm don hold d driver..na d matter we de try settle since under rain
3..one guy use fake alert pay bride price n d family neva see alert for 2 months now and the bride don already carry belle, we de station like this..
4..student call lecturer baby for online class..na d matter the lecturer wife and the girl with d.p.o de settle like this
5..wife see husband with sidechick de enter hotel and sharply call d.p.o to go arrest the bea n the d.p.o kum c say na him wife be d side chick...na d matter we de settle since last nite

3 Likes 2 Shares

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Callertunez: 6:40pm On May 28, 2020
angry


my guy flog Army man pikin because them dey make noise... since morning, him dey try to fill 5 basket with water... na the matter wey dey my compound laidis

1 Like

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Nobody: 7:37pm On May 28, 2020
Callertunez:
angry


my guy flog Army man pikin because them dey make noise... since morning, him dey try to fill 5 basket with water... na the matter wey dey my compound laidis

My guy, Na so DJ go play Alora music for Aiye party... Na why I just dey come NL since yesterday. We still dey try settle the matter
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by glimpse33(m): 7:55pm On May 28, 2020
Virgin girl wey we suppose use for sacrifice, igwe Don go Fvck am.
We dey beg native doctor since yesterday.

3 Likes

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Ifebaby16(m): 7:59pm On May 28, 2020
paulolee:
hear say angel Gabriel don sell trumpet wey him supposed blow for world to end...we de try gather matter settlers to go settle am
2..motor jam who de go settle matter and dm don hold d driver..na d matter we de try settle since under rain
3..one guy use fake alert pay bride price n d family neva see alert for 2 months now and the bride don already carry belle, we de station like this..
4..student call lecturer baby for online class..na d matter the lecturer wife and the girl with d.p.o de settle like this
5..wife see husband with sidechick de enter hotel and sharply call d.p.o to go arrest the bea n the d.p.o kum c say na him wife be d side chick...na d matter we de settle since last nite

cheesy grin
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by reigncalif1: 8:19pm On May 28, 2020
e be things wet dey flow sinc na it I go use without Knowing the meaning.nah wahala I dey for like this
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Callertunez: 8:22pm On May 28, 2020
0KNM:


My guy, Na so DJ go play Alora music for Aiye party... Na why I just dey come NL since yesterday. We still dey try settle the matter
cheesy
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by zexy2030(m): 8:27pm On May 28, 2020
Na my girlfriend o, she call me this night say make I send am 3k say she dey stranded for transport, na em I tell am say na 5k remain for my account, say make she manage 1.5k na em I do mistake transfer of 150k for the babe, na d mata we dey settle like this... how I won collect the money na...abeg advice..

1 Like

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by GeneralPula: 8:29pm On May 28, 2020
grin
Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Freelane33(m): 8:50pm On May 28, 2020
Come help me settle this matter . The crab no wan accept apology grin grin

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Auladimeji(m): 9:05pm On May 28, 2020
.

Re: Which Matter Dem Dey Setttle Now ? by Gabflex: 10:05pm On May 28, 2020
olosho don get belle for my neighbor wey be Reveren father ooo, babe dey our domot since morning say father must Marry her.
we go continue tomorrow

(1) (Reply)

Lady Proposed To Boyfriend In A Mall, Watch What Happened / The Days When Love Use To Be Priority No1 / I Need A Sex Mate Around Lagos/ogun State

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.