Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,173,885 members, 7,889,931 topics. Date: Monday, 15 July 2024 at 03:43 AM

“corruption Na Who Sef?” By Chidi Anthony Opara - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / “corruption Na Who Sef?” By Chidi Anthony Opara (619 Views)

Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)

(1) (Reply)

“corruption Na Who Sef?” By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 12:10pm On Nov 04, 2011
Every politician for Naija
Promise to fight am,
Every Naija government
Talk say
Dem dey fight am,
Upon dat
Corruption still full ground.

Our money loss
Dem say
Na corruption thief am,
Our property loss
Dem say
Na corruption carry am,
Corruption na who sef?

So tee
Dem come get anty corruption
For inside government.
Dem get am sef
For outside government.
Small time
Dem go get uncle corruption.

Dem say
Dem dey fight corruption,
Upon dat
Corruption still full ground,
Corruption na who sef?

(1) (Reply)

Get Ebook On Any Topic / Pathway To Greatness / Finding Inner Peace

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 6
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.