Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,199,055 members, 7,970,259 topics. Date: Wednesday, 09 October 2024 at 03:26 AM

Waffy Yan - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Waffy Yan (876 Views)

2face In Ghana, 2dozen Girls Get Bellie? I-yan Tv.....simply Hilarious / 2face In Ghana 2dozen Girls Get Bellie? I-yan Tv Simply Hilarious / Yan Arewa Represent! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Waffy Yan by swagalish: 2:40pm On Apr 19, 2012
UDUAGHAN: "Bros migwuo!!!…na wa o…dis pipo nor try o…I hear say na 13 yrs dem give you".

IBORI : "You dey crase for there u dey hear me so? Why u nor come here come show solidarity for court? U dey asaba dey form his excellency abi? Nor worry…e go soon red for u"
...
UDUAGHAN: shuuu…bros whish levo (level) naa? why u dey harsh for me naa? Whish one be solidarity for the mata again?

IBORI : why I nor go harsh? U nor see wen dem carry dat okpolo-eye go court? U nor see say all im boys wey e make governor dem follow am go Abuja go show solidarity? U wey I expect to show for the background nor come, na all doz mumu dem u send come here come carey (carry) paper (placard). U nor see as dem pursue all of dem comot from the full court like shidren (children)?

UDUAGHAN: do’oo…nor vex abeg…next time I go try come…

IBORI : U nor well o…whish one be next time naa?

UDUAGHAN: errrhhmm…..

IBORI : nor worrey (worry)….na me dull maself sha…

UDUAGHAN: how bros?....

IBORI : u nor sheck (check) am? Like say dat day wey farida send all doz zombie dem come oghara I just respect maself follow dem ehn, by now I for just dey flenjor o…all dem olanipekun for don bail me dat year na…and na so so adjournment we for dey reach now o…dis yeye oyibo pipo nor just waste time…na na na na dem don give me free lodging…

UDUAGHAN: na so bros…

IBORI : na dat good for nothing Goodluck na im cause all dis one for me so o…

UDUAGHAN: errhhmm….bros…u know say I nor fit talk put for dat one…all dis SSS boys fit dey tap dis call so….

IBORI : anyhow sha nothing spoil…I hear say dem wan send all my money come Delta so…abeg ehn, just help me keep am well, wen I show for the background, I go just hol it (have it).

UDUAGHAN: bros e nor go easy o…I hear say if u do finish show back ehn, na kirikiri get you o…

IBORI : Ur fada!
Re: Waffy Yan by Afam4eva(m): 2:42pm On Apr 19, 2012
Lmao

(1) (Reply)

China Product! / A Prof And A Police / Lol..... How To Lose Fat Quickly

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.