Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,173,992 members, 7,890,248 topics. Date: Monday, 15 July 2024 at 11:39 AM

I Dey Make N8k Everyday - Fake Blind Beggar For Lagos Confess - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / I Dey Make N8k Everyday - Fake Blind Beggar For Lagos Confess (341 Views)

Police Threatens "Blind" Beggar With Tear Gas, See What Happened Next. Photos / Fake Female Blind Beggar Caught In Lagos, Knelt Down & Disgraced By Mob / 'I Make N8,000 Daily' - Fake Blind Beggar Apprehended In Lagos Confesses (2) (3) (4)

(1) (Reply)

I Dey Make N8k Everyday - Fake Blind Beggar For Lagos Confess by NewsinPidgin(f): 3:00pm On Aug 22, 2017
Fake blind beggar wey him name na Abdullahi Abbas, wey dem catch for Ikorodu area for Lagos state yesterday, August 21st, don confess say him dey make between N5,500 and N8,000 everyday just say him na beggar.

Na one 12-year-old boy wey dem no gree mention him name bin dey epp Abdullahi to dey beg every day for First Gate and Odogunyan area wey dey Ikorodu.

Dem catch am yesterday after one person wey dey live for d area wey her name be Adeoye Baliks, follow am dey talk and him raise eyebrow.

As Vanguard talk am, na imm she shout and den people wey dey pass come check d man come find out say true true him no blind.

As dem ask am questions, Abdullahi talk say him from Oyo state, and say him dey among one group of beggars wey dey pretend say dem get some kind illness just to collect money from people wey go pity dem.

If no be as vigilante group members for the area ruah go d place, people wey gather bin wan burn d man already.

Na dese vigilante people rescue am come hand am over to police for Sagamu.

#confamtori
Source: http://newsinpidgin.ng/i-dey-make-n8000-everyday-fake-blind-beggar-for-lagos-confess/

(1) (Reply)

419ers / Fraudulent Fundraisers For Miss Stella Meeikya,victim Of Gas Explosion @ / Exclusive! Billionaire Kidnapper, Evans To Face Court Wednesday

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.