Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,208,199 members, 8,001,876 topics. Date: Wednesday, 13 November 2024 at 05:53 PM

Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M - Jokes Etc (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M (4112 Views)

Which Matter Una Dey Settle For Your Side Na? / Abeg Which Matter Dem Dey Settle Now..? / Na The Matter We Dey Settle. (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by riversproperty(m): 10:41pm On May 29, 2020
Papa Chinedu don sell all him six plots of land, sell him one and only car, use him only house wey him dey live borrow money from cooperative add join him life saving carry send Chinedu go Obodo oyinbo. Chinedu come back yesterday after one month for New York tell him Papa say Cold too much for there...

Na the matter we still dey settle since yesterday oo

3 Likes

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by riversproperty(m): 10:43pm On May 29, 2020
h
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by Iykejohn419(m): 10:55pm On May 29, 2020
ademidedavid:

Aaahhhh, this matter need spiritual Intervention

Lol

No be small spiritual intervention

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by riversproperty(m): 11:01pm On May 29, 2020
See the matter wey we dey settle for my compound since yesterday

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 11:07pm On May 29, 2020
riversproperty:
Papa Chinedu don sell all him six plots of land, sell him one and only car, use him only house wey him dey live borrow money from cooperative add join him life saving carry send Chinedu go Obodo oyinbo. Chinedu come back yesterday after one month for New York tell him Papa say Cold too much for there...

Na the matter we still dey settle since yesterday oo
Aaaahhhhh Chinedu has offended the gods of the land be that oooooo, but how we go take settle this kind matter ?
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 11:07pm On May 29, 2020
riversproperty:
h
For house?
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by Mr2kul(m): 2:25am On May 30, 2020
ademidedavid:
The igwe just transferred the case to the governor
Let's see if the Governor will be able to settle it

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 7:33am On May 30, 2020
Mr2kul:

Let's see if the Governor will be able to settle it
If governor no fit settle the matter I doubt if baba presido go even get any idea on how to settle be that oooo......we go just all relocate go another happening matter be that....lol
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 7:46am On May 30, 2020
Nurse don go mistakenly give abortion medicine to a woman wey don dey find pikin since 20yrs,haa the matter no gree settle since yesterday oo,we still dey hospital now to see if we can settle the matter.
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 7:46am On May 30, 2020
Na Aso Rock we dey, Buhari mistakenly sign 2 years for lockdown instead of two weeks na d matter we dey settle
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 7:48am On May 30, 2020
Emeka don go pick money for ground come turn fowl. The problem no be say Emeka pick money, the matter be say e don enter papa Ade poultry, I no come know which fowl be Emeka

The matter neva settle o, we still dey find Emeka � #TheMatters

2 Likes 2 Shares

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by Mr2kul(m): 11:58am On May 30, 2020
ademidedavid:

If governor no fit settle the matter I doubt if baba presido go even get any idea on how to settle be that oooo......we go just all relocate go another happening matter be that....lol
Swears grin

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by riversproperty(m): 12:35pm On May 30, 2020
ademidedavid:

Aaaahhhhh Chinedu has offended the gods of the land be that oooooo, but how we go take settle this kind matter ?


My brother, the matter don enter Igwe palace as we speak oo!!
Chinedu say him pity him papa that na why him come back to Nigeria. According to am, him calculate all the money wey him papa don spend so e no go good make him come still die of cold over there Because that will amount to total loss and disaster for the old man. Chinedu tell Igwe say if there’s life, there’s still hope....

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 2:32pm On May 30, 2020
riversproperty:



My brother, the matter don enter Igwe palace as we speak oo!!
Chinedu say him pity him papa that na why him come back to Nigeria. According to am, him calculate all the money wey him papa don spend so e no go good make him come still die of cold over there Because that will amount to total loss and disaster for the old man. Chinedu tell Igwe say if there’s life, there’s still hope....

Aaaahhhhh this case pass corona virus own oooooo, but Chinedu get point sha but how the papa go take pay all him debt now?
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by riversproperty(m): 10:30pm On May 30, 2020
ademidedavid:

Aaaahhhhh this case pass corona virus own oooooo, but Chinedu get point sha but how the papa go take pay all him debt now?


Chinedu tell him papa say When there’s life, there’s hope

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 7:02am On May 31, 2020
riversproperty:



Chinedu tell him papa say When there’s life, there’s hope
Chinedu nah man abeg

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 11:52am On May 31, 2020
Latest matter arising,
My Oga give me him army uniform make i go dry clean na so I wear him cap dey feel like boss, gbam I see one nigga dey play with him babe I come feel say he dey harass her na so I move closer give him better slap feeling like a soldier. Immediately he salute me say am sorry sir.
Before I know my Oga don show for my back wire me better slap akpan you never go dry clean my uniform and you even get mind wear my cap....na so the bros I slap call my Oga, Victor, immediately my Oga see am, he salute am and salute Oga madam immediately...... Immediately I sabi say the matter no fit ever settle as I don't slap my Oga Oga
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 2:29pm On May 31, 2020
I hear say some ladies dey settle others matter so tey dem forget say them never see their period......na wa oooooo

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 5:43pm On May 31, 2020
Junior don tell him papa to change the key to him mama paradise because papa Nkechi get the duplicate......na the matter we dey settle since oooo
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by Hotspotbro(m): 7:20pm On May 31, 2020
And..

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 9:00pm On May 31, 2020
Hotspotbro:
And..
Aaaaaahhhhh, mother in the Lord is a distributor........ Lol, this matter be as he get ooooo
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by fresh20(m): 9:30pm On May 31, 2020
ademidedavid:
More to relax our nerves

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by fresh20(m): 9:32pm On May 31, 2020
E don happen my guy go borrow person shoe, na him the guy use tesumole scatter the shoe.
Na the matta we dey settle since.....!

2 Likes

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 2:24am On Jun 01, 2020
fresh20:
E don happen my guy go borrow person shoe, na him the guy use tesumole scatter the shoe.
Na the matta we dey settle since.....!
Lol......e su is definitely involved in the matter, he go hard sha
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 5:30am On Jun 01, 2020
*BREAKING NEWS*

ALL SCHOOLS ARE TO RESUME ON MONDAY

primary
Secondary
Tertiary institution
Are to resume on Monday

*BUT I DON'T KNOW WHICH MONDAY EXACTLY SHA*

*We are still on the matter. I will communicate to you latter��‍♂️��‍♂️��‍♂️*
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 12:28pm On Jun 01, 2020
Common post wey I post, lalastica block me, na the matter we dey settle since oooooo
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by fresh20(m): 9:53pm On Jun 01, 2020
ademidedavid:

Aaaahhhhh Chinedu has offended the gods of the land be that oooooo, but how we go take settle this kind matter ?

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by fresh20(m): 9:55pm On Jun 01, 2020
lol...We must ask the gods to settle dis matta... wink

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 11:11am On Jun 02, 2020
fresh20:
lol...We must ask the gods to settle dis matta... wink
but if the god's fail to settle this matter......please, the god's are not to blame!
Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by Rejomar(m): 5:29pm On Jun 02, 2020
Baba don give yahoo boy soap make him carry baff him brother don carry am wash plate,nah d mata we stll dey settle since morning,we don tire sef.

1 Like

Re: Abeg Which Matter Una Dey Settle For Area Today Cos Since 5am I Don Dey Settle M by ademidedavid(f): 9:58pm On Jun 02, 2020
Rejomar:
Baba don give yahoo boy soap make him carry baff him brother don carry am wash plate,nah d mata we stll dey settle since morning,we don tire sef.
Aaaaaaahhhhhh, make the guy just ready to dance naked for market ooo

(1) (2) (3) (Reply)

All About Cars / Difference Between Complete And Finished. / This Is What You Get When You Snapped With Nokia 3310

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.