Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,180,109 members, 7,910,011 topics. Date: Saturday, 03 August 2024 at 05:17 PM

Man Wey Dey Reason - Literature (16) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Man Wey Dey Reason (553363 Views)

As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) / Ibo Boy Wey Like Yoruba (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (112) (Reply) (Go Down)

Re: Man Wey Dey Reason by babaskiola(m): 11:11pm On Mar 20, 2013
flow1759: make una help me ask mayor46 wetin him dey talk oh?

Hahahaha flow na only you go understand wetin him dey yarn oo
Re: Man Wey Dey Reason by arizona145(m): 11:27pm On Mar 20, 2013
And, "poooooaaaaaah!!" she poured the content of the bucket on us.


Ths ur eyes go soon go blind oooo. The other time na soup abi na shit H20 (water), ths time again na boiled H20. Guy take ‎​A̶̲̥̅♏ Nwayoly oooooo make flow eyes no go blank oooooo
Re: Man Wey Dey Reason by johnwizey: 11:28pm On Mar 20, 2013
Flow,na u go pay my hospital bill o if i get laughing sickness. Thumbs up man
Re: Man Wey Dey Reason by Mayor46(m): 11:36pm On Mar 20, 2013
U too dey strong....u fit kill woman for bed
Re: Man Wey Dey Reason by opeoluwa2(f): 11:41pm On Mar 20, 2013
Checking ,no update??
*sadface*
Re: Man Wey Dey Reason by MrAnoTi(m): 1:31am On Mar 21, 2013
Flow Na the kind thing wey good for you be that.. Shebi yu no fit close ya mouth.. Abeg continue tori jare
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 5:46am On Mar 21, 2013
Gud a m guyz, oya flow wia u dey?
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 8:04am On Mar 21, 2013
Monday came with the thought of kpokponity.


"guy, shebi una know say all of una for that house na Graduate, na only me still dey look for Admission, that one no mean say all of una senior me oh, i be old man oh, i don write JAMB five times, this one wey i wan write dis year go make am six" Man narrated as we walked to the site after eating at Mama Calabar canteen.


"e no mean anything na, no worry you go get am this year" Brainbox sympatized with Man.


"you be Olodo be that na, no worry na until JAMB give u award na that time you go know, if na kponkpon Exam dem dey write u go pass am" i dared not say that.

I could still feel the unending burning sensation in my neck as a result of the "hot water bath" Kate gave us.


We arrived a bit late at the site that morning.


"Old solja good morning" We chorused. "ehen, unu good morning" Old solja replied.


"Madam Ifeoma don come, she talk say today unu go mould block, say as the casting don finish make unu mould block wey unu go use start the body of the work" Old solja narrated, "Old solja she give u money abi?" the money concious Igbakwambo asked.


"yes na, she give me money make i pay unu after work, she say she dey go somewhere nahim make she say make i come watch unu as unu go work today" Old Solja replied. "but Old solja how much be the price to chop one biscuit na?" Man asked.


"na 20naira for one biscuit na, na the normal price wey dem dey pay everywhere na" Old solja replied.


"Chop biscuit" was the code name for moulding building blocks. So the amount of biscuit you "chop" would determine how much you would smile home with.


Work started.
Since I and Brainbox were inexperience in "choping Biscuit" we teamed up with Man our "Master". While Igbakwambo and Ochagbuorie made a deadly team.


I and Brianbox were mixing the cement and sand with our shovel and pouring it for Man who was moulding and offloading the blocks.


After about 1hour of hard labour, the half time Scores was: Team Man 51blocks - Team Igbakwanbo 62blocks. How on earth can Igbakwambo and Ochagbuorie be stronger than three able bodied men? Unless of course they drank overdose of Tea before coming to work.


Just when i said we needed to increase our speed, Old solja glanced at I and Brainbox as we were practically fighting with our shovel, then he said, "Flowa and Brain make unu mix the cement and sand well well oh".


"Old Solja our name na Flow and Brainbox, no be Flowa and Brain" i corrected.


At the end of the day, Team Igbakwambo won with 105blocks, while Team Man moulded 86 blocks only.


Rice and Beans was sure more Lucrative than Biscuit, or so i thought.

Mixing Rice and Beans was sure more hectic than Choping Biscuit, or so i thought.


After the "Biscuit choping", it was time to eat, not to eat Biscuit but to swallow Fufu.


When such urge beckons, the thought of Soroagwa came to mind.


The problem that lies ahead was how to share the Biscuit money.

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 8:58am On Mar 21, 2013
D money na 50-50
Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 9:40am On Mar 21, 2013
@4kizo
Me I no gree with that

@flow
86 biscuits x #20= #1,720
#1,720 /3 (team Man- Flow,Brainbox & Man)

Man = #620 (since he was the manager)
Flow =#550
Brainbox = #550

No be so?

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 9:42am On Mar 21, 2013
@HNB
That will work for me..
With your 56 + my 5.6,we can make smtin out of that..
Doesn't deter me jare....
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 10:21am On Mar 21, 2013
dayleke: @4kizo
Me I no gree with that

@flow
86 biscuits x #20= #1,720
#1,720 /3 (team Man- Flow,Brainbox & Man)

Man = #620 (since he was the manager)
Flow =#550
Brainbox = #550

No be so?
If so, den flow nd brainbox no suppse share equal nah
Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 11:03am On Mar 21, 2013
Well,let's wait and see maybe L103 will be introduced here,lol

But for real,Flow and Bb for get equal share because dem no sabi nah..
Re: Man Wey Dey Reason by YOUNGKAHUNA: 11:15am On Mar 21, 2013
I Love All This Slangs U Are Making Use Of...........Flow On Bro
Re: Man Wey Dey Reason by seuncyber(m): 11:46am On Mar 21, 2013
AS A WRITTER U MUST BE GOOD IN ALL WAYS,ACTION, JOKES, THRILLER, SUSPEND, ROMANCE, EDUCATIVE ETC,THIS IS WHAT YOU HAVE FLOW.

KEEP THE GOOD WORK GOING WE LOVE AND WE LOVE YOUR WORK...

NICE STORY AND WRITTING
Re: Man Wey Dey Reason by valboy20(m): 11:47am On Mar 21, 2013
oga mason n labourerx no dey share dsame amount.....xo;

man:::720

brain:::500

flow:::500
Re: Man Wey Dey Reason by temhab(f): 12:15pm On Mar 21, 2013
I've missed a lot. More grease to your elbow Flowey
Re: Man Wey Dey Reason by morley411(m): 12:57pm On Mar 21, 2013
Guy U̶̲̥̅̊ too much ride on U̶̲̥̅̊ don become celebrity Oº°˚˚˚˚°ºo.
Re: Man Wey Dey Reason by morley411(m): 1:07pm On Mar 21, 2013
cryGuy U̶̲̥̅̊ must continue dis story Oº°˚˚˚˚°ºo. It keeps me going cry
Re: Man Wey Dey Reason by Bluediamond1(f): 2:13pm On Mar 21, 2013
Dis guy,u 2much.
Re: Man Wey Dey Reason by dandollaz: 3:03pm On Mar 21, 2013
Flow u better com quick b4 guys for NL go share ur money n BB finish oooo grin
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:54pm On Mar 21, 2013
morley411: cryGuy U̶̲̥̅̊ must continue dis story Oº°˚˚˚˚°ºo. It keeps me going cry

morley my manest man, i see you ma nigga
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 6:00pm On Mar 21, 2013
No update?
Re: Man Wey Dey Reason by donez(m): 6:30pm On Mar 21, 2013
Flow u make sense!
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 7:13pm On Mar 21, 2013
"Soroagwa, i want Fufu and Okro soup, u go mix am small Egusi, u go com add am small vegetable soup" Man ordered for almost all the soups in the world, i was imagining how the mixture would look like.


"ehen Flow take dis 500naira, na ur biscuit money be dat" Man said offering me a worn out 500naira note. "Brainbox na your own be dis" He offered Brainbox his own 500naira.


"una know say Biscuit work na nonesense work, and person no dey use Biscuit work get better money, if person wan get better money the person go mix rice and Beans be that" Man said.


"how much you com collect?" the Brainy Brainbox asked "i collect 600naira, i give Old solja 120, u know say that Man try for us, him no tackle us like Madam Ifeoma dey do" Man said. Only God knows if he actually gave Old solja the money he said he gave him.


"guy my skin don spoil finish oh, see as my skin white" I complained. "u no dey rob that vaseline wey i keep for site?" Man inquired, "i dey rob am na" i replied. "no worry, naso e do me when i just start kponkpon, e go stop" Man assured.


Soroagwa brought the "concoction".

The concoction looked mouth watering to me, so i ordered, "Soroagwa bring the same thing for me", "na 300naira for a plate if u want the mixture oh" Soroagwa said. "no wahala bring am like that, add am one bottle of Coke join" I ordered without thinking.


If my tongue could speak, it would have attested to the fact that the concoction was delicious, but my prayer was that the concoction should seat confortably in my stomach.


Legend has it that the first day one eats a food that his/her system isn't used to, there is a 60% chances that he/she would throw up.


As i continued eating, i wished that i wouldn't throw up in the near future. Just a wish, and like the saying goes: "if wishes were horses, beggers will ride".


After the concoction meal, i paid, and i was given a change of 130naira which was the only money left with me.


Well, it was the Only money left with me because earlier that morning, i had hide all the money with me in my bag, leaving home with only 250naira; of which i used to pay after eating at Mama Calabar's canteen. I was advised by the Brainy Brainbox to do so, his words: "Flow, since we dey go work and we go get money, no need to carry money go, if u carry money go site, u go spend am, and person need to dey save oh"


Though i locked my bag with a padlock, but my prayer was that the Notorious BIG shouldn't pay our room a visit. A visit to steal.

Or else i would be doomed.
Re: Man Wey Dey Reason by Nobody: 7:14pm On Mar 21, 2013
Flow i dey feel your flow die
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 7:43pm On Mar 21, 2013
seuncyber: AS A WRITTER U MUST BE GOOD IN ALL WAYS,ACTION, JOKES, THRILLER, SUSPEND, ROMANCE, EDUCATIVE ETC,THIS IS WHAT YOU HAVE FLOW.

KEEP THE GOOD WORK GOING WE LOVE AND WE LOVE YOUR WORK...

NICE STORY AND WRITTING

thank you so much. So much fun and laughter lies ahead, just keep ur fingers crossed.
Re: Man Wey Dey Reason by Nobody: 8:02pm On Mar 21, 2013
.
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 8:03pm On Mar 21, 2013
temhab: I've missed a lot. More grease to your elbow Flowey

for all of una wey dey read my story and all of una wey dey comment, i thank una well well, my prayer for una be say:
may una first son never resemble una landlord at the top.
Re: Man Wey Dey Reason by Ladybianca(f): 8:39pm On Mar 21, 2013
tears
of laughter rolling dwn my cheeks......flow u re d best jor.....btw am
an imsu babe, am in my finalz nw, thnk am havn a crush on u........''or
so i tot'' in flow's voice.....kip it up.
Re: Man Wey Dey Reason by johnwizey: 8:39pm On Mar 21, 2013
flow1759:

for all of una wey dey read my story and all of una wey dey comment, i thank una well well, my prayer for una be say:
may una first son never resemble una landlord at the top.
so,wu b our landlord at the top
Re: Man Wey Dey Reason by opeoluwa2(f): 9:05pm On Mar 21, 2013
[quote author=Ladybianca]tears of laughter rolling dwn my cheeks......flow u re d best jor.....


Seconded

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (112) (Reply)

BROKEN HEDGE By Toyin Taiwo / My Life On Campus (A True Life Story). / Red Ashes

Viewing this topic: 1 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.