Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,193,368 members, 7,950,765 topics. Date: Monday, 16 September 2024 at 09:34 PM

Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) - Dating And Meet-up Zone (13) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) (38323 Views)

Romance Chat/hookups/Poems Section(PIDGIN ENGLISH ONLY) / Dave2's Mahjong Parlour with his Buddies! / The Beer Parlour (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (10) (11) (12) (13) (14) (15) (16) ... (30) (Reply) (Go Down)

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 5:16pm On Jun 24, 2012
Where acid and co?
i need one bottle of dry gin.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Brite02(m): 5:27pm On Jun 24, 2012
Assistant barman, Errrrr.. Na so una dey do 4 dz bar abii, sote barman dey gv mzdarkskin free shekpe(drink) without charge..

Abeg guy, pass me 2 shots of that drink there make i koøool dz cold mood, my gf dey come with money i go pay ma bills
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 5:44pm On Jun 24, 2012
Brite02: Assistant barman, Errrrr.. Na so una dey do 4 dz bar abii, sote barman dey gv mzdarkskin free shekpe(drink) without charge..

MsDarkSkin is just that special. That's why. cool cheesy
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Brite02(m): 5:55pm On Jun 24, 2012
MsDarkSkin:

MsDarkSkin is just that special. That's why. cool cheesy
na him i dey seeeeee becos of u dz sunday wey make barman dey form kingkong.. Barman i dey wait 4d kini na
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by ProfAmu(m): 6:01pm On Jun 24, 2012
Goldieluks: Where acid and co?
i need one bottle of dry gin.

Dry gin, no more eva water. angry angry
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 6:42pm On Jun 24, 2012
Goldieluks: Where acid and co?
i need one bottle of dry gin.


See no ever call my name again if you enter this bar you hear me? Dey go meet my second.

You wey I say make I press you nyansh to see if e soft like your palm, you come dey shout on me in presence of all these drunkards.

Say I dey run bar no mean say I no go school oh!
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Jamesdman(m): 7:09pm On Jun 24, 2012
I don show, i don show. . . My fellow drunkards,furkers and ganjer men and women, i hail o! Hw una weekend be lyk na?
Barman how ur side na, o'boy i see ur younger sister for church 2day. I jst dey trip for her, abeg runs her for me na. Na that kind gud gal i need for my lyf, she fit change me for the better. . . Meanwhile, pass me five bottles of harp!
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 7:10pm On Jun 24, 2012
acidtalk:


See no ever call my name again if you enter this bar you hear me? Dey go meet my second.

You wey I say make I press you nyansh to see if e soft like your palm, you come dey shout on me in presence of all these drunkards.

Say I dey run bar no mean say I no go school oh!

Why this bar come dry like this na..Acidtalk i beg i need one bottle of Ogidiga today na sunday..I no wan drink get high too much as i get work tomorow morning around 8 am....
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 7:11pm On Jun 24, 2012
fuckherlord:

if I sit down for your side you go marry me

quick marriage dey las vegas

correct bar boku for las vegas

make we go reckless


sure na dere u de ?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 7:50pm On Jun 24, 2012
Barman, gimi 1bottle of kunu embarassed embarassed
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mynd44: 7:51pm On Jun 24, 2012
I don land now. Barman abeg give me one star make I start.
@all, I hail ooo
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 7:58pm On Jun 24, 2012
^Watin u dey do here? dem nor preach 4ur church 2day say dash shall not drink
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 8:06pm On Jun 24, 2012
Sijo01: ^Watin u dey do here? dem nor preach 4ur church 2day say dash shall not drink


So...Jesus self talk say make person Jolly when time reach....And for ur information na cele church me i de go now and my pastor self de drink why me follow follow no go do the same thing ?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 8:10pm On Jun 24, 2012
^Mak u nor follow watin ur pastor dey do oo.

If u must drink, mk u dey drink holy-communion.

Barman, abeg nor vex say i dey spoil ur market o.
Nor sell beer 2day. Mak u sell only cmmunion win.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mynd44: 8:15pm On Jun 24, 2012
Sijo01: ^Watin u dey do here? dem nor preach 4ur church 2day say dash shall not drink
Dem talk am ooo. But a my name no be dash wetin I go do?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 8:23pm On Jun 24, 2012
^Kai, so u nor even kno book.
Dash nor b person name, na commandmnt, u hear.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mynd44: 8:54pm On Jun 24, 2012
Sijo01: ^Kai, so u nor even kno book.
Dash nor b person name, na commandmnt, u hear.
but sey commandment dey drink shepe wey them come talk say make e stop?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 8:55pm On Jun 24, 2012
Prof Amu:

Dry gin, no more eva water. angry angry


i feel like drinking something strong tonight. wink


acidtalk:


See no ever call my name again if you enter this bar you hear me? Dey go meet my second.

You wey I say make I press you nyansh to see if e soft like your palm, you come dey shout on me in presence of all these drunkards.

Say I dey run bar no mean say I no go school oh!

You bar man you no dey fear face? touch wetin?? and you see say na me be hot cake for this joint.
You wan spoil my racket? abi na bar man i go come allow touch wetin?? abeg abeg face front, make you offer me
some dry jin..
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 8:57pm On Jun 24, 2012
E be like say I go employ on of the directors for KPMG or Arthur Anderson or even Rotimi Willaims, the way wey account no dey balance for this bar I no like am.

I go even buy cctv instal for here. Imagine last night the Vigilante people see SEUN and SEXKILLZ as dem jump fence come steal money for our vault.

If to employ Accountant and buy cctv too much, I go kuku hire Boko Haram boys make dem come dey guard this bar when we close.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 9:02pm On Jun 24, 2012
Goldieluks:


i feel like drinking something strong tonight. wink




You bar man you no dey fear face? touch wetin?? and you see say na me be hot cake for this joint.
You wan spoil my racket? abi na bar man i go come allow touch wetin?? abeg abeg face front, make you offer me
some dry jin..

You see yourself?
All these drunkards no get shinshin for pocket. Na gbese dem dey buy drink.

If you gree for me ehn, you go enjoy me well well.

I get like 6 houses for Borno, 4 for yobe, 8 for Maiduguri, 3 for Kaduna and like 12 for Gombe. As a bad sharp guy, I dey buy some of those properties like even N15,000 and people dey even beg me to buy from them.

If you gree for me, I go open shop for you in any of those regions wey you go dey sell tuwo chinkafa, zobo rodo and kunu.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by amuukwu1(m): 9:34pm On Jun 24, 2012
[quote author=Goldieluks]


i feel like having something strong in me tonight. wink



How strong do you want it. grin cheesy grin
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 9:50pm On Jun 24, 2012
acidtalk:

You see yourself?
All these drunkards no get shinshin for pocket. Na gbese dem dey buy drink.

If you gree for me ehn, you go enjoy me well well.

I get like 6 houses for Borno, 4 for yobe, 8 for Maiduguri, 3 for Kaduna and like 12 for Gombe. As a bad sharp guy, I dey buy some of those properties like even N15,000 and people dey even beg me to buy from them.

If you gree for me, I go open shop for you in any of those regions wey you go dey sell tuwo chinkafa, zobo rodo and kunu.


see this ogogoro background bar man.
na me you wan open zobo and kunu shop for? Abi you never here about me for this region??
Go ask wella, make you come back give me reply. ##give me the dry gin jor#



[quote author=amu ukwu][/quote]

i know no wetin u dey talk about abeg.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:21pm On Jun 24, 2012
Goldieluks:


see this ogogoro background bar man.
na me you wan open zobo and kunu shop for? Abi you never here about me for this region??
Go ask wella, make you come back give me reply. ##give me the dry gin jor#



I don ask about you, and people say that kin business too Behind for you. Dem say make I find you corner for near one school make you take dey sell donkwa, kilinshi and kulukuli.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 10:43pm On Jun 24, 2012
acidtalk:


I don ask about you, and people say that kin business too Behind for you. Dem say make I find you corner for near one school make you take dey sell donkwa, kilinshi and kulukuli.



my belle don scatter with laff. grin grin grin
See as you dey confuse me for your wife, because the palmy when you dey take brush teeth
every morning don dey affect your ADL.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 10:57pm On Jun 24, 2012
Goldieluks: [/b]


my belle don scatter with laff. grin grin grin
See as you dey confuse me for your wife, because the palmy when you dey take brush teeth
every morning don dey affect your ADL.

What is happening here...Acid Bobo where u de i need big stout and give goldie wetin she want jare...No fighting tonight
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 11:04pm On Jun 24, 2012
millinmax2:

What is happening here...Acid Bobo where u de i need big stout and give goldie wetin she want jare...No fighting tonight

thank you sir... cheesy
bar man--acidtalk #speaking in queens english# can i have three bottles of beer,three
glasses of palmy and two bottles of eva water please. Reserve the extras please
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 11:06pm On Jun 24, 2012
millinmax2:

What is happening here...Acid Bobo where u de i need big stout and give goldie wetin she want jare...No fighting tonight

Oga, if you know wetin good for you begin dey go your house oh!

My padi dem for up north (those chairmen them), come do their emergency meeting for lagos and na here dem dey meet.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 11:08pm On Jun 24, 2012
Goldieluks:

thank you sir... cheesy
bar man--acidtalk #speaking in queens english# can i have three bottles of beer,three
glasses of palmy and two bottles of eva water please. Reserve the extras please

Common carry your mouth go corner joh!
Na so you sabi english reach wey at your age you still dey struggle to pass common entrance to enter js1.

Na me you wan come open eye for.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 11:12pm On Jun 24, 2012
Goldieluks:

thank you sir... cheesy
bar man--acidtalk #speaking in queens english# can i have three bottles of beer,three
glasses of palmy and two bottles of eva water please. Reserve the extras please



My dear do u care for Asun and Cat fish ? Also can i take u home tonight ? shocked grin grin grin Acid bobo how much is the total bill i beg grin grin grin grin
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 11:19pm On Jun 24, 2012
Brite02: Assistant barman, Errrrr.. Na so una dey do 4 dz bar abii, sote barman dey gv mzdarkskin free shekpe(drink) without charge..

Abeg guy, pass me 2 shots of that drink there make i koøool dz cold mood, my gf dey come with money i go pay ma bills
so na ur gf dey work u no dey work, and if u make me vex al dose aristol wey i dey arange give ur gf i wil stop it. No credit today come tomorow...matchew
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 11:23pm On Jun 24, 2012
Brite02:
na him i dey seeeeee becos of u dz sunday wey make barman dey form kingkong.. Barman i dey wait 4d kini na
e be like say we go open another small joint 4 dose debtors o! U can imagine dis one self dey talk
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 11:28pm On Jun 24, 2012
Goldieluks:

thank you sir... cheesy
bar man--acidtalk #speaking in queens english# can i have three bottles of beer,three
glasses of palmy and two bottles of eva water please. Reserve the extras please
oga u no remenbe dis man, d man wey dey teach patience jonathan english b4 dey sack him, he also cary phone enter comon entrance exam...any way take one botle to cool ur temper *giving him one bottle of legend*

(1) (2) (3) ... (10) (11) (12) (13) (14) (15) (16) ... (30) (Reply)

Dates And Hook_ups. Drop Ur Number And Pic(if Any). / Tea With Lola / I Need A Hiv Positive Guy For Serious Relationship

Viewing this topic: 1 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 68
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.